Difference between revisions of "service"
(→Verb) |
|||
Line 40: | Line 40: | ||
* [[nack]], | * [[nack]], | ||
====Translations==== | ====Translations==== | ||
− | * English: ''car servicing'',''to have sex'' | + | * English: ''car servicing'', ''to have sex'' |
Revision as of 15:36, 7 July 2021
Naija
Etymology
From: English service
Pronunciation
- sɛ́vìs
Noun
- Time wey de dey use worship for church.
- I bin go morning service. — (Egbokhare_2021, I went for church service in the morning.)
- Im wan go service. — (ENU_22_Barman-Interview_MG__59, He wants to go to church service.)
- Di short form wey de dey take call di National Youth Service Corps (NYSC) wey student wey finish university dey use serve deir papa country, Naija.
- I con go for service for Bayelsa State. — (WAZP_07_Imonirhua-Lifestory_MG__26, Then I went into the Youth Service Corps in Bayelsa State.)
- Okay so my plan be sey, if I finish from here, I finish my NYSC, I for don finish my service, I go do, I wan do my masters. — (NST_cleaned__2030, I plan to pursue a masters degree after completing national youth service.)
- Di kind ting wey private company or government office people de do for person collect money or for e hand.
- Make sure say your network get good coverage before you use di service. — (bbc__64929, Be sure to have stable internet network first so you can enjoy using the service.)
- Oga in charge for di service say di business get profit yakata if you know di koko. — (bbc__77035, The boss providing the service affirmed that the business is quite profitable so long as one knows the ropes.)
- Dis new service go dey on top digital platforms and go use Pidgin wey dem dey speak for West and Central Africa as dem language. — (bbc__41872, The new service which will be in West and Central African Pidgins will be on the internet and other online platforms.)
- Na network for internet wey e de dey inside person phone.
- If you like go buy kpalasa phone o, na so service go hard you find see. — (NSC_Abonyi_221, If you buy a regular phone you may find it hard to get network access.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: church service, National Youth Service Corps (NYSC), service, internet network
Verb
- Na as de dey change oil wey dey inside motor engine put new one and clean inside motor engine make e dey work fine more more.
- E good make person dey service motor or generator before e make engine no go knock. — (NST_2021, A car or generator should be serviced from time to time so the engine does not become faulty.)
- Na sey man dey sleep with woman.
- Husband wey dey service e wife well no dey get di kind problem wey di one wey no dey service e own well go get. — (NSC_Abonyi_221, The problem that a husband who has regular sex with his wife may encounter in his marriage differs from that of his counterpart who falls short in that regard.)
Synonyms
- nack,
Translations
- English: car servicing, to have sex