touch
Naija
Etymology
From English: touch
Pronunciation
- tɔ̂tʃ
Verb
- Make person body meet wit anoder person own.
- Husband and wife fit touch demsef anyhow, e no wrong. — (NSC_Legbeti_2021, A couples are free to engage in all kinds of romance.)
- Some women ehen, once dem husband touch dem like dis, na belle straight. — (NSC_Legbeti_2021, Some women are very fertile, once they make love with their husbands, they get pregnant.)
- Make person try beat or try start fight with anoder person.
- No touch dat pikin if not you go see my red eye! — (NSC_Legbeti_2021, Don't think of beating that child or you will have me to contend with.)
- Touch me, and you go know! — (IBA_41_Christ-Passion-Finale_MG__45, Touch me, and you will know!)
- Make person or someting meet anoder person or someting.
- No touch your radio o. — (WAZA_12_Lady-G_M__33, Don't touch your radio.)
- If you touch stove wey dey hot wit your hand, e go burn you o! — (NSC_Legbeti_2021, If you touch a hot stove, you will burn your hand.)
- Make person talk someting wey fit dey do person church mind one kind kind.
- De beggar talk wetin touch me. — (NSC_Legbeti_2021, The beggar's tale broke my heart.)
- This one go help us touch their heart. — (jw__37097, This one will help us melt their hearts.)
- Make someting fit scatter someting.
- No touch our peace, say no to violence. — (bbc__97092, Do not disturb the peace, avoid violence.)
- So as to avoid tori wey dey touch. — (bbc__9317, So as to avoid disruption.)
- Make person dey play or carry someting wey e no suppose take.
- I go tell Oga say you don dey touch company money. — (NSC_2021, I will inform the boss that you have been tampering with company's money.)
- To dey do am every three-three month no too much, especially if you get very fine phone wey people just like to dey touch. — (bbc__80573, Quarterly security check is not too much especially if people tamper with your phone often.)
- Make person craze.
- Him begin craze after wire wey dey him brain begin touch. — (NSC_2021,He has lost his sanity.
- Di wire dey touch. Im head dey touch. — (Egbokhare_2020, He is suffering from mental issues.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: touch,disrupt, crazy