suffer
Naija
Alternative forms
Etymology
From English suffer.
Pronunciation
- sófà
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 36
- Frequency rank in NSC treebank: 301
- Frequency in raw corpus: 1145
- Frequency rank in raw corpus: 323
Noun
Na sey someting no balance for person or someting life or sey someting dey hard for am.
- Di suffer don too much well, well. — (ONI_23_Things-Don-Cost_DG__131, The suffering is unbearable.)
- People wey survive ebola for Sierra Leone don dey suffer new suffer, dem call am human rights violation. — (bbc__81025, Survivors of ebola in Sierra Leone are now plagued by another problem known as human rights violation.)
- From that time, the kind suffer wey we dey suffer now don pass wetin we fit use mouth talk. — (jw__20686, From that point on, we experienced suffering that is beyond describing.)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: suffering
Verb
suffer: abuse, maltreat Make someting no balance for person or someting life or sey someting dey hard for am.
- Dem no go torture or suffer any pikin. — (Egbokhare_2021,)
- Na im go comot suffer. — (jw__25694, __no translation__)
- We dey here dey suffer. — (ONI_01_Salary-Wahala_M__62, We are here suffering)
- Upon wetin Job suffer, e no leave God. — (jw__41397, __no translation__)
- Sometimes, e fit remember wetin e suffer. — (jw__9801, __no translation__)
- Come suffer di way me I dey suffer. — (NST_cleaned__14046, __no translation__)
- na di consumers na dem dey suffer dis thing — (deuber__1303, __no translation__)
- We dey here dey suffer. — (NST_cleaned__22197, __no translation__)
- I go dey here dey suffer. — (NST_cleaned__6839, __no translation__)
- Jehovah allow Satan suffer Job. — (jw__3962, __no translation__)
- Instead, Jehovah let Satan suffer Job. — (jw__41828, __no translation__)
- Life wey suffer no dey. — (jw__22229, __no translation__)
- Carry your pole of suffer — (jw__5913, __no translation__)
- This one come make dem suffer for many years. — (jw__17404, __no translation__)
- I no know sey na double suffer, I go go suffer for Lagos. — (IBA_01_Fola-Lifestory_MG__38, I didn't know the hardship would be twice as bad in Lagos.)
- Why suffer suffer full this world? — (jw__46800, __no translation__)
- Bible talk about how Jesus take suffer before e die. — (jw__4665, __no translation__)
- Fear and cry cry and suffer go comot. — (jw__10553, __no translation__)
- Na im make wahala, pain and suffer suffer full this world. — (jw__552, __no translation__)
- Anyone wey e choose fit make am suffer or enjoy life. — (jw__5869, __no translation__)
- Na wetin Adam do dey make us suffer and die today.— Read Genesis 3: 1-6, 19 . — (jw__26629, __no translation__)
- E sey: ‘Make una happy even when people curse una and suffer una. — (jw__3593, __no translation__)
- ‘People go catch una and suffer una, dem go carry una go synagogue and dem go put una for prison. — (jw__49272, __no translation__)
- Which time this suffer suffer go end? — (jw__45940, __no translation__)
- De reasons, bishops say na poor pipo weh de no fit send dia pikin dem for Francophone regions di suffer. — (bbc__27652, __no translation__)
- God dey make us suffer wen we sin. — (bbc__3036, __no translation__)
- But for me, me, I wan suffer meh I get my own. — (JOS_05_Buhari-Government_M__25, But for me, I, I want to suffer so that I will get mine.)
- Why Jehovah never still do something about all this suffer suffer? — (jw__46275, __no translation__)
- Why many people dey blame God for the suffer suffer wey dey this world? — (jw__46751, __no translation__)
- Pikin dem weh deh di go school di suffer plenti stigma, as deh di call dem 'Bamenda' and deh de feel laik some second class pipo. — (bbc__81334, __no translation__)
- But no be only Daniel di suffer dis kain tin, e reach about 500,000 pipo wey dey suffer spinal cord injury for di world and di case for Nigeria dey worse because medical care dey very cost. — (bbc__23114, __no translation__)
Related forms
Synonyms
Antonyms
Translations
- English: abuse, maltreat