cram
Naija
Etymology
From: English cram
Pronunciation
- krâm
Verb
Transitive
- Make person sabi someting for head without sey im carry book or get helper.
- I don cram di book for head. — (Egbokhare_2020. I have memorised the book.)
- I cram de moto plate number for head since. — (NSC_Legbeti_2021. I had long memorized my car's plate number.)
- I cram de style for head from de day I see her wear am. — (NSC_Legbeti_2021. I had memorized the style from the day I saw it on her.)
- De way de guy dey call her number everytime show say he don cram am for head. — (NSC_Legbeti_2021. His ceaseless calls shows he must have memorized her number.)
- Our children like to dey cram Bible verse. — (jw__3222. Our children like memorising bible verse.)
- But, e dey talk sey e no good to dey cram prayer and dey repeat am. — (jw__19596, But he said it is wrong to cram prayers and repeat it.)
Intransitive
- I sabi cram o. — (NSC_Legbeti_2021. I know how to memorise.)
- I never still see how to cram. — (NSC_Legbeti_2021. I haven't seen anyone capable of cramming.)
Translations
- English: memorise