akara
Naija
Etymology
From Yoruba: akara (bean cake)
Pronunciation
- àkàrà
Noun
- Food wey dem dey make from beans wey dem grind, mix am with pepper, onions and crayfish, con fry small small like ball.
- Since dem born me, I never see who sabi fry akara like Ijesha women. — (NSC_Legbeti_2020. For as long as I can remember, nobody fries beanballs better than the Ijesha women.)
- If I eat akara, I go dey mess. — (Egbokhare_2020, If I eat fried beanballs, I fart uncontrollably.)
- Na every time e dey buy akara give Ekwefi carry go home for Ezinma. — (katakata__834, He sends beanballs to Ezinma regularly and sends it to her through Ekwefi. )
Translation
- English: akara, bean cake
Adjective
- Na when someting no serious, like small pikin ting.
- comot for here! You think say na akamu and akara matter na im we dey talk for here? — (NSC_Legbeti_2020. Leave here! do you suppose the matter at hand is for children?)
- You know, we dey go akara school dat time. — (WAZL_15_MC-Abi_MG__121, In those days, we attended schools for little children.)
Translations
- English: childish, irrelevant