hammer
Naija
Alternative Forms
Etymology
From: English hammer
Pronounciation
- hámà
Noun
- Wetin person dey take nack nail enter wood.
- Di way this carpenter hold hammer eh e clear sey e sabi work. — (The carpenter is using the hammer like an expert.)
Translation
- English: hammer
Verb
- Make person get correct money.
- All man dey hustle make dem hammer by fire by force. — (Everyone is trying to become rich by all means.)
- Na sufferhead na im make many people dey born plenty pikin. De go dey reason sey one of dem fit hammer. — (Poverty is why many people give birth to a lot of children. They think that at least one of them may become rich.)
- Make someting do person.
- Suffer hammer dat uncle sotey na agbekpo e begin do. — (That man suffered so much that he became a sewage evacuator.)
- As hunger hammer am, no be person tell am make e go drink garri. — (As he became hungry, he didn’t need to be told to drink garri.)
Translations
- English: "to hit jackpot"