mouth
Naija
Etymology
From: English mouth
Pronunciation
- maʊt
Noun
- Wetin person take dey chop, laugh and talk
- You sure sey dat pikin wey never pass 5 years fit take im small mouth chop tiko? — (NSC_Odirin_2020, Are you sure that that child who is not above 5 years can use her mouth to eat dried meat?)
- Momoh, Momoh, dat your mouth wey you dey take laugh me, na dat same mouth you go take come beg me. — (Deuber__1957, Momoh, Momoh, you will yet apologise to me with the very mouth that you are insulting me with.)
- Na for person to sabi talk
- I get mouth. — (NSC_ , I am sharp-tongued.)
- Na for talk to dey serious
- No be for mouth; — (bbc__74913, I am not being boastful.)
- Na just mouth. — (NST_cleaned__40780, It is just mere talk.)
- Na agreement
- Na one mouth di husband and wife go take talk di matter give landlord. — (NSC_Odirin 2020, The couple should be in unison when discussing the matter with the landlord.)
- Sabi people no use one mouth talk about am. — (bbc__63901, Experts had different opinions on the issue.)
- Na ordinary talk.
- Na only mouth politicians for Nigeria sabi make. — (NSC__Odirin 2020, Nigerian politicians are plain insincere.)
- Na when person get say for someting.
- Nigeria get mouth for plenty things wey dey appun for Di Gambia. — (bbc__73654, Nigeria is involved in most of the intrigues in The Gambia.)
- Wetin dey person mind
- Na EndSARS dey everybodi mouth now for Naija. — (NSC_Odirin 2020, The EndSARS protest is trending in Nigeria.)
- On January 18 2019, Atiku close di mouth of im opponents dem wen im land US for di first time afta 12 years. — (bbc__77604, On January 18 2019, Atiku silenced his critics when he eventually arrived US after a 12 year hiatus.)
Related forms
Translations
- English: mouth