akamu

(Redirected from Akamu)

Naija

Etymology

From: Igbo (pap)

Pronunciation

  • àkàmù

Play Play

Noun

  • Food wey de make from corn, millet and jiru, wey be sey dey go soak am con leave am make e tay small, con comot di back. When de don sieve am, de go con use hot water make am. E dey soft well well wen de make am finish.
  • I dey like beans and akamu for morning.  — (I like eating beans and pap in the morning.)
  • akamu na children food.  — (Pap is food for children not adult.)

Translation

  • English: pap

Adjective

  1. Wetin dem dey call man wey no get power
    • di man na akamu e be jare, see as woman cary am up knack am for ground gbosa.  — (The man is very lazy. A woman lifted him up and smashed him on the floor.)
    • Any girl wey marry man wey be akamu go suffer.  — (A girl married to a man who is not manly will suffer.)
  2. When matter no go hard dem settle.
    You say di girl no gree your matter? Ol'boy, na akamu matter be dat  — (The girl has refused to date you? that is a small problem brother)
    • When God don ready to help person, village people wahala na akamu matter for am.  — ( When God is ready to uplift a man, eliminating ancestral problems is is quite easy for him.)

Translations

  • English: lazy, weak, soft, easy