backyard

Naija

Etymology

From: English backyard

Pronunciation

  • bàkíjâd

Play Play

Definition

  • Area wey dey back of house.

Noun

  1. Di area wey dey behind the house.
    • Di ball fall go backyard.  — (NSC_Legbeti_2020. The ball fell towards the back of the house.)
    • Or maybe na your backyard, you for cut am.  — (NST, 38102. Did you get it from the back of your house?)
  2. Where person get power abi get advantage put.
    • I go die de matter for you no worry, all dat area where de wahala for happen na my backyard.  — (NSC_Legbeti_2020. Relax, I will settle the problem for you because where the trouble happened is within my stronghold.)
    • If you dey work for technology field, to live for Yaba go favor you die because your office fit even dey your backyard.  — (If you work in the field of technology, living in Yaba will be a big advantage as you can just find you live close to your workplace since Yaba is the center of technological activities)
  3. Woman yansh wey big wella.
    • Dat chick get better backyard o.  — (Egbokhare, 2020. That girl has big buttocks.)
    • O boy, dat babe backyard na die!  — (NSC_Legbeti_2020. Boy, that girl has large buttocks)

Adjective

  • When e be sey something dey local, small, or below person level
  • I no wan work for backyard restaurant.Chuy!  — (Deuber, 3559. my level is above working at a local or small restaurant Please!.)
  • Na my company you dey call backyard restaurant?  — (Deuber, 3560. Is it my company you are referring to as local please?)

Related form

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: Area behind the house, one's area of strength, a woman's buttocks, something small or local.