block
Naija
Etymology
From English: block
Pronunciation
- blôk
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 1
- Frequency rank in NSC treebank: 2859
- Frequency in raw corpus: 410
- Frequency rank in raw corpus: 762
Noun
- Wetin dey use cement make, wey strong, wey dey dey use build house.
- Each block sef, we dey get like, like twenty houses for each block. — (NST_cleaned__22841, From each bricks, we get twenty houses for each bricks.)
- Na dirty wey dem fit recycle dem dey use to build di block — (bbc__70590, The bricks are built from the recycleable dirts.)
- Water wey don taye for freezer wey don strong.
- I dey buy block put for my drinks since light no dey. — (NSC_Olukayode.S.M_2020, I buy big icecubes to make my drinks cold as a result of lack of power supply.)
- I dey sell block and pure water for park. — (NSC_Olukayode.S.M_2020, I sell icecubes and satchet water at the car park.)
Related form
Synonym
Translations
- English: bricks, big icecubes
Verb
Transitive
- Make person meet anoder person.
- If you no block di lecturer, you no go pass o. — Egbokhare_2020, If you do not meet with the Lecturer, you won't pass the course.)
- I go block di James for office. — (NSC_2021, I will meet Jame in the office.)
- Make dem stop person or someting.
- APC dey use moni block women to run for political office... — (bbc__8626, APC is using money in hindering the women from running for political offices...)
- Di storm blow away ships wey dem park come block di harbour so other ships no fit pass. — (bbc__38597, The storm blew away the ships parked at the harbour, blocking other ships from passing. )
Intransitive
Make dem use someting cover someting or somewhere.
- Dem come use big stone block the front. — (jw__28089, Big stones were used to block the front.)
- We come use newspaper take block the space. — (jw__9371, We use newspaper to block the space.)
- Dem block di Lagos/Abeoukuta express way. — (bbc__53089, They blocked the Lagos/Abeokuta express way.)
Translations
- English: bribe, block