block
Naija
Etymology
From English: block
Pronunciation
- blôk
Noun
- Wetin dey use cement make, wey strong, wey dey dey use build house.
- Each block sef, we dey get like, like twenty houses for each block. — (NST_cleaned__22841, From each bricks, we get twenty houses for each bricks.)
- Na dirty wey dem fit recycle dem dey use to build di block — (bbc__70590, The bricks are built from the recycleable refuse.)
- Water wey don overcold con strong like stone.
- I dey buy block put for my drinks since light no dey. — (NSC_Olukayode.S.M_2020, I buy ice block to make my drinks cold as a result of lack of power supply.)
- I dey sell block and pure water for park. — (NSC_Olukayode.S.M_2020, I sell ice blocks and satchet water at the car park.)
Related form
Synonym
Translations
- English: bricks, big ice cubes
Verb
Transitive
- Make person bribe anoder person.
- If you no block di man, you no go get di work. — NSC_Olukayode.S.M_2021, If you don't bribe the man, you won't get the job.)
- Make person meet anoder person.
- I go block di James for office. — (NSC_2021, I will meet-up with James in the office.)
- Make dem stop person or someting.
- Di former chairman don block who bin want follow im pikin contest. — (NSC_2022, The former chairman has hindered the person who wanted to contest with his/her child.)
- Di storm blow away ships wey dem park come block di harbour so other ships no fit pass. — (bbc__38597, The storm blew away the ships parked at the harbour, preventing other ships from passing. )
Translations
- English: meet-up, hinder, bribe, block