fightfight

(Redirected from fight-fight)

Naija

Alternative Form

fight fight

Etymology

From: English fight

Pronunciation

  • fȃitfȃit

Play Play

Noun

  • Wetin dey happen wey be sey people dey too dey quarrel.
  • Fightfight no get who e pay.  — (Quarrelsomeness benefits no one.)
  • Na your hand e dey. If you carry fightfight go meet am , na wetin you go see.  — (It’s in your hands. If you show them quarrelsomeness, that’s what you’ll see.)

Translation

  • English: quarrelsomeness

Adjective

  • Person wey too dey like quarrel.
  • E no get who dem born bad ting follow. Pikin wey be sey na fightfight pikin, e get where e dey see fightfight.  — (No one is born bad. A troublesome child sees troublesomeness somewhere.)
  • Your husband material no even reach one yard. You go be fightfight husband.  — (You are not suitable to be a husband. You’ll be a very quarrelsome husband.)

Related forms

fight

Translation

English: troublesome, quarrelsome

Verb

  • Make person too dey beat person.
  • Some people wahala na to dey fightfight all di time.  — (The problem some people have is fighting at all times.)

Translation

  • English: quarrel