first

Naija

Alternative form

fess

Etymology

From: English first

Pronunciation

  • fɛ̂st

Play Play

Noun

  • Make dem take position, make person come before oder people
  • Na me carry First for our class for dis year.  — (NSC_Legbeti_2021, I took the first position in class this year.)
  • Shola na my First wife.  — (NSC_Legbeti_2021, Shola is my first wife.)

Related forms

first position

Adjective

  • Make someting come before odas.
  • Toh di very first story wey dey my hand for today, na im, dey yarn o.  — (IBA_32_Tori-By-Samuel_MG__1, Well, the very first story I have for today is the one I'm talking about.)
  • Make someting no good from beginning.
  • Na di very first day wey dem inaugurate dis 8th assembly dia yawa start.  — (bbc__70567. The crisis started on the first day of the inauguration of the 8th assembly.)

Adverb

  • Wetin suppose dey, before any oder ting go come follow.
  • First boil am.  — (ENU_11_Delicious-Beans-And-Plantain_M__17, First of all, boil it.)
  • Dey first look who dey di door before you open am.  — (NSC_Legbeti_2021, Ensure you know who is at the door before opening it.)
  • Me I for say di First ting person wey wan marry suppose do na to find wife.  — (NSC_Legbeti_2021, If you wish to get married, first, look for a wife.)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: foremost