force

Naija

Etymology

From: English force.

Pronunciation

  • fɔ́s

Play Play

Noun

  • Na to stand say person must do someting.
  • Na by force.  — (NST_cleaned__28523. You must do it! )
  • Dem wan marry by force.  — (KAD_15_Money-Wahala_MG__27, They want to get married at all cost.)
  • Na when de power wey someting take happen push anoder ting to happen.
  • As ground draw am fall down, all de drinks she carry fall come break.  — (NSC__2021. As she slipped, all the drink on her head hi the floor too and broke.)
  • Micheal Adikwu di suspect wey die, na from Benue State and na former police officer wey dem bin dismiss from di force.  — (bbc__67096. )
  • Dem by force all di staff to move go di ground floor and dem dey harass pipo dia because na by force dem use to enta di building.  — (bbc__4571, __The staff were forced to the ground floor after gaining entrance into the building forcefully.__)
  • Na group wey deir own na to use power do someting.
  • Goment don send special force go Kaduna  — (bbc__54480. The government has sent a special squad to Kaduna.)
  • Once all dose agbero reach here now, everywhere fit scatter because deir own na so so force.  — (NSC_2021. If the touts get to this venue, everywhere will become disorderly as they will apply violence.)
  • Make person or someting dey give support or dey encourge person or someting
  • My Mama na strong force for her women meeting.  — (NSC_2021, My mother is influential in the women's meeting.)
  • Im say Annan na guiding force for good.  — (bbc__33995, He said Annan is a source of encouragement.)
  • Make person dey work for police
  • My Papa dey work for force.  — (NSC_2020, My father works with the police force.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: Vigour

Verb

    • Na to use power do someting.
  • Him use force rape me.  — (bbc__8417. He forcefully raped me.)
  • When some people try force dia way, e cause stampede.  — (bbc__13519, __no translation__)
  1. Authorities use heavy force stop di protests and at least 500 people die.  — (bbc__18106, __no translation__)
    Court no go force pikin do wetin e no suppose do.  — Egbokhare_2020. no translation
    Abuse for lawyers, authorities no di lef lawyers see dia customers, deh di torture for get informate from suspects and de way de justice system di work force dem for for de sit-in strike.  — (bbc__11265, __no translation__)
  1. Some people feel say dis one go force people wey want plenty memory to buy di new iPhone 8.  — (bbc__91361, __no translation__)
    As di case bin start, di EC bin dey try prove say to vote no be human right as di people wey carry dem go court dey talk, and dem go implement di ROPAA law, so make nobodi force dem.  — (bbc__16780, __no translation__)
    For global updates, UNHCR say de report weh dem get show say after weh deh arrest and force 47 Anglophone community leaders for return to Cameroon, violence hot again for Southwest and Northwest.  — (bbc__51659, __no translation__)
    Gofment no plan to seize lands from states, colonize territories or force Ruga ontop any partrt of di federation, gofment don clear dat one again and again say di programme no compulsory. Na so di statement tok.  — (bbc__3044, __no translation__)


Synonyms

Translations

  • English: impose