force

Naija

Etymology

From: English force.

Pronunciation

  • fɔ́s

Play Play

Noun

  • Na to stand say person must do someting.
  • Na by force.  — (NST_cleaned__28523. You must do it! )
  • Dem wan marry by force.  — (KAD_15_Money-Wahala_MG__27, They want to get married at all cost.)
  • Na when de power wey someting take happen push anoder ting to happen.
  • As ground draw am fall down, all de drinks she carry fall come break.  — (NSC__2021. As she slipped, all the drink on her head hi the floor too and broke.)
  • Micheal Adikwu di suspect wey die, na from Benue State and na former police officer wey dem bin dismiss from di force.  — (bbc__67096. )
  • Dem by force all di staff to move go di ground floor and dem dey harass pipo dia because na by force dem use to enta di building.  — (bbc__4571, __The staff were forced to the ground floor after gaining entrance into the building forcefully.__)
  • Na group wey deir own na to use power do someting.
  • Goment don send special force go Kaduna  — (bbc__54480. The government has sent a special squad to Kaduna.)
  • Once all dose agbero reach here now, everywhere fit scatter because deir own na so so force.  — (NSC_2021. If the touts get to this venue, everywhere will become disorderly as they will apply violence.)
  • Make person or someting dey give support or dey encourge person or someting
  • My Mama na strong force for her women meeting.  — (NSC_2021, My mother is influential in the women's meeting.)
  • Im say Annan na guiding force for good.  — (bbc__33995, He said Annan is a source of encouragement.)
  • Make person dey work for police
  • My Papa dey work for force.  — (NSC_2020, My father works with the police force.)

Related forms

Synonyms

Translations

  • English: Vigour

Verb

  • Na to use power do someting.
  • Him use force rape me.  — (bbc__8417. He raped me.)
  • De whole katakata start when some people come force deirself enter de stadium.  — (NSC_2021. The stampede happened following forceful entry by some fans.)
  • Court no go force pikin do wetin e no suppose do.  — Egbokhare_2020. The court cannot act against the will of a child.)
  • Some people feel say dis one go force people wey want plenty memory to buy di new iPhone 8.  — (bbc__91361, Some believe those interested in money will buy the new iPhone 8.)


Synonyms

Translations

  • English: impose