gbese

Naija

Alternate form

igbese

Etymology

From: Yoruba

Pronunciation

  • gbèsè

Play Play

Noun

  1. Money wey person suppose give person sake of sey e don collect money or market from am.
    • Di money wey you dey borrowborrow up and down so, na heavy gbese e go be for you tomorrow o.  — NSC_Agnes_2020 (The loan you go about seeking now will become heavy debt on you tomorrow.)
    • Because when you go take gbese, after marriage now, instead of you to dey enjoy di marriage, you go dey tink how you take dey pay debt.  — (ABJ_INF_06_Marriage-Counselling_DG__121, If you take loan to cover the cost of marriage, after the marriage, instead of enjoying the marriage, you will keep thinking of how to pay back.)
    • Di kain gbese wey pipo dey enta for burial make Catholic Bishops for east of Nigeria to condemn di practice.  — (bbc__35416, The debts people were incurring over elaborate burial led the Catholic Bishops of the East to condemn the practice)
  2. Wahala wey person enter wey pass am.
    • You carry your papa moto comot, go jam person moto, you don chop gbese  — (NSC_2021, While driving your father's car, if you hit someone, you have put yourself in real trouble.)
    • Okada man don fall woman wey carry egg, e don enter gbese.  — (NSC_2021, The commercial motorcyclist hit the woman carrying eggs, and he is now in serious trouble.)
    • Person wey dey do boyboy don go carry gbese, e give im oga sister belle.  — (NSC_2021, The apprentice who put his boss' sister in the family way is now in a lot of trouble.)
    • One of dose agbero wey dey stay for junction don go use bottle break person head. Make e dey pray sey di person no die, because if die, na serious gbese.  — (NSC_2021, One of those touts who stay at the junction has smashed someone's head with a bottle. Let him pray the person survives, otherwise he will be in serious trouble.)

Synonyms

credit, gbege

Translations

  • English: debt, trouble, damage