jam

Revision as of 17:00, 5 September 2021 by 160.152.8.198 (talk) (→‎Naija)

Naija

Etymology

From: English jam

Pronunciation

  • dᶚám

Play Play

Verb

  • Na make dem use people head knock each other.
  • I no sabi jam people head togeder I beg.  — (NSC_Legbeti_2021. Please I dont know how to turn people against each other.)
  • So, you no quick see say Chichi wan jam your head with Chuks head make una for no fit marry if not sey God pass am?.  — (NSC_Legbeti_2021. So, but for God, you almost didnt realize Chichi's plan was to upturn things and prevent the marriage between you and Chuks?)
  • Na make body touch body.
  • Oga, I no like di way your body dey jam my body for dis Molue o shift go back small biko.  — (NSC_Legbeti_2021. I detest the way your body rams into mine from behind in this bus, kindly adjust please.)
  • When my body jam your own dis night, I swear you no go gree go back dis weekend.  — (NSC_Legbeti_2021. When we make love tonight, I am sure you wont leave this weekend. )
  • Na make wetin hit pesin spoil someting.
  • Who jam your moto for back?.  — (NSC_Legbeti_2021. Who hit your car from behind?.)
  • Na di day you go jam soldier for road na im you go know say make pesin dey drive one way fit comot teeth.  — (NSC_Legbeti_2021. Until the day you run into the army personnel and get beaten, you will not desist from driving against on-coming cars.)

Noun

  • Na wetin sweet wey pesin fit take chop bread.
  • Di way jam take dey finish for dis house, pesin no know whether spirit dey join us eat am walahi.  — (NSC_Legbeti_2021. The rate at which jam is consumed in this house make one doubt the number of persons living in the house. )
  • Di first time dis my mout touch jam, only me nearly chop di bottle finish. Di ting sweet die.  — (NSC_Legbeti_2021. The first time I ate jam, I almost emptied the bottle, it was so sweet!)

Synonyms

Translations

  • English: Jam