jam

Revision as of 15:00, 10 November 2021 by EmekaFelixO (talk | contribs) (→‎Naija)

Naija

Etymology

From: English jam

Pronunciation

  • d͡ʒám

Play Play

Verb

  1. Make someting use force touch anoder ting.
    • Who jam your moto for back?  — (NSC_2021, Who hit your car from behind?.)
    • {{ux|dv| How many people di keke jam? |(NSC_2021, How many people did the tricycle hit.
  2. Make de talk or do wetin go make person and person get wahala.
    • I no sabi jam people head togeder abeg.  — (NSC_2021, Please I don't know how to turn people against each other.)
    • So, you no quick see sey she bin want jam your head wit your husband mama head make you and your husband no marry, if e no be sey God pass am?  — (NSC_2021, Didn't you quickly realize that if not for God she was trying to cause a rift between you and your mother inlaw so that the wedding will not hold?)
  3. Make body touch body.
    • Oga, I no like di way your body dey jam my body for dis Molue o, shift go back small abeg.  — (NSC_2021, Sir, I don't like the way you are rubbing your body against me in this bus, please move back.)
  4. Make person and person nack
    • When my body jam your own dis night, I swear you no go gree go back dis weekend.  — (NSC_2021, When we make love tonight, I am sure you wont leave this weekend.)
  5. Make pesin see someting.
    • As I jam Igbo garri for market, I buy three rubber sharp sharp.  — (NSC_Legbeti_2021, When I found where the garri from the Igbo area was sold, I bought three measures.)
    • As I jam my mama for di show, I pass back comot.  — (NSC_Legbeti_2021, When I saw my mother at the show, I went through the back door.)
    • Na di day you go jam soldier for road and de comot like two teeth for your mouth na im you go know sey to drive one way na bad ting.  — (NSC_2021, The day you run into the army offices and loose maybe tooth or two, that's when you'll know that violating the one-way drive law can get you in trouble and get beaten.)

Synonyms

Translations

  • English: hit, insigate, have sex, make contact