mouth

Revision as of 16:52, 15 October 2020 by 154.66.36.58 (talk) (→‎Noun)

Naija

Alternative forms

maut

Etymology

From: English mouth

Pronunciation

  • maʊt

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 18
  • Frequency rank in NSC treebank: 503
  • Frequency in raw corpus: 1125
  • Frequency rank in raw corpus: 326

Definition

part of human being bodi wey dey under nose wey person dey take talk and chop

Noun

  1. Wetin person take dey chop, laugh and talk
    You sure sey dat pikin wey never pass 5 years fit take e small mouth chop tiko?  — (NSC_Odirin_2020, Are you sure that that child who is not above 5 years can use her mouth to eat dried meat?)
    Momoh, Momoh, dat your mouth wey you dey take laugh me, na dat same mouth you go take come beg me.  — (Deuber__1957, Momoh, Momoh, that your mouth that you are using to laugh at me, it is that same mouth that you will use to come and apologise to me.)
    dem say wetin come out for di mouth dey cause many wahala mostly if na bad one  — (deuber__5813, they said that what comes out of the mouth can cause many problems especially when it is negative)
    If you fit get dis two things correct, na customers go use dia own mouth sell di movie for you.  — (bbc__4423, If you can get these two things correctly, the customers will use their own lips to promote the movie for you.)
  2. to sabi talk
    I get mouth.  — (NSC_2020, I am sharp-tongued.)
  3. when person mean wetin e talk
    No be for mouth;  — (bbc__74913, It is not just by words.)
  4. when person no mean wetin e talk/comot for e belle
    Na just mouth.  — (NST_cleaned__40780, It is just mere talk.)
    Sabi people no use one mouth talk about am.  — (bbc__63901, Experts had different opinions on the issue/ did not have a single opinion.)
    Na wetin make Jesus talk wetin prophet Isaiah talk about dem, when e sey: ‘Na mouth this people take dey respect me, but their mind no dey my side at all.  — (jw__4457, It is what made Jesus refer to what prophet Isaiah said about them when he said: This people respect me only with their lips.)
  5. when person behave like sey e no send person/someting
    Aha she chop, clean mouth.  — (LAG_38_Elections_DG__127, Aha, she ate and did not yield.)
  6. to dey join settle matter for people
    Nigeria get mouth for plenty things wey dey appun for Di Gambia.  — (bbc__73654, Nigeria is involved with a number of things that is happening in the Gambia)
  7. wetin dey person mind
    But dem dey find wetin dey Jesus mouth, so that dem go arrest am.  — (jw__32363, But they were looking for a way to find Jesus' opinion so that they will arrest him.)
    Oloye Idowu Olukunle get anoda mouth for di mata.  — (bbc__77360, Oloye Idowu Olukunle has a different opinion on the matter.)
  8. authority wey person get
    Na di mouth of di special adviser on top petroleum matter and energy matter dis order fall comot.  — (deuber__1770, It is the special adviser on Petroleum and Energy who gave this order.)
  9. for person to shut up/keep quiet
    On January 18 2019, Atiku close di mouth of im opponents dem wen im land US for di first time afta 12 years.  — (bbc__77604, On January 18 2019, Atiku shut the mouths of his opponents when he first landed in US after 12 years)
  10. wetin person go put eye ontop
    Tori be say na sports and politics na im Weah go put eye and mouth ontop.  — (bbc__95224, The news is that the sports and politics.)
  11. matter wey dey people mind or wey dey reign
    Na EndSARS dey everybodi mouth now for Naija.  — (bbc__36028, NSC_Odirin 2020, It is EndSARS that is presently on everybody's mouth in Nigeria.)
  12. when person dey boast
    People wey no get levels sabi make mouth make dey like dem.  — (NSC__Odirin 2020, People who do not have charisma tend to boast so that they would be liked.)

Related forms

Antonyms

nyansh

Translations

  • English: mouth