mouth

Naija

Alternative forms

maut

Etymology

From: English mouth

Pronunciation

  • maʊt

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 18
  • Frequency rank in NSC treebank: 503
  • Frequency in raw corpus: 1125
  • Frequency rank in raw corpus: 326

Definition

Part of human being bodi wey dey under nose wey person dey take talk and chop

Noun

  1. Wetin person take dey chop, laugh and talk
    • You sure sey dat pikin wey never pass 5 years fit take e small mouth chop tiko?  — (NSC_Odirin_2020, Are you sure that that child who is not above 5 years can use her mouth to eat dried meat?)
    • Momoh, Momoh, dat your mouth wey you dey take laugh me, na dat same mouth you go take come beg me.  — (Deuber__1957, Momoh, Momoh, that your mouth that you are using to laugh at me, it is that same mouth that you will use to come and apologise to me.)
    • Dem say wetin come out for di mouth dey cause many wahala mostly if na bad one  — (deuber__5813, they said that what comes out of the mouth can cause many problems especially when it is negative)
    • If you fit get dis two things correct, na customers go use dia own mouth sell di movie for you.  — (bbc__4423, If you can get these two things correctly, the customers will use their own lips to promote the movie for you.)
  2. To sabi talk
    • I get mouth.  — (NSC_2020, I am sharp-tongued.)
  3. Serious talk
    • No be for mouth;  — (bbc__74913, It is not just by words.)
    • Na just mouth.  — (NST_cleaned__40780, It is just mere talk.)
    • Sabi people no use one mouth talk about am.  — (bbc__63901, Experts had different opinions on the issue/ did not have a single opinion.)
    • Na wetin make Jesus talk wetin prophet Isaiah talk about dem, when e sey: ‘Na mouth this people take dey respect me, but their mind no dey my side at all.  — (jw__4457, It is what made Jesus refer to what prophet Isaiah said about them when he said: This people respect me only with their lips.)
  4. To talk join matter
    • Nigeria get mouth for plenty things wey dey appun for Di Gambia.  — (bbc__73654, Nigeria is involved with a number of things that is happening in the Gambia)
  5. Person mind
    • But dem dey find wetin dey Jesus mouth, so that dem go arrest am.  — (jw__32363, But they were looking for a way to find Jesus' opinion so that they will arrest him.)
    • Oloye Idowu Olukunle get anoda mouth for di mata.  — (bbc__77360, Oloye Idowu Olukunle has a different opinion on the matter.)
    • Na EndSARS dey everybodi mouth now for Naija.  — (bbc__36028, NSC_Odirin 2020, It is EndSARS that is presently on everybody's mouth in Nigeria.)
  6. Authority
    • Na di mouth of di special adviser on top petroleum matter and energy matter dis order fall comot.  — (deuber__1770, It is the special adviser on Petroleum and Energy who gave this order.)
    • On January 18 2019, Atiku close di mouth of im opponents dem wen im land US for di first time afta 12 years.  — (bbc__77604, On January 18 2019, Atiku shut the mouths of his opponents when he first landed in US after 12 years)

Related forms

Translations

  • English: mouth