name

Revision as of 01:15, 9 February 2021 by 102.89.0.194 (talk) (→‎Naija)

Naija

Etymology

From: English name

Pronunciation

  • nêm


Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 87
  • Frequency rank in NSC treebank: 155
  • Frequency in raw corpus: 2388
  • Frequency rank in raw corpus: 169

Noun

  1. na wetin dem dey call person or someting.
  • My name na Agnes but you fit call me Agy.  — (NSC_Legbeti_2021. My name is Agnes but you can call me Agy.)

C: E get another sister, wey im name be Reylene.  — (jw__8158, She had another sister called Reylene)

  1. Na de way wey people take dey look anoder person.
  • Me I know say dem go don give me bad name for work as I no dey gree take bribe like dem so.  — (NSC_Legbeti_2021. I know they would have maligned against me for refusing to collect bribe like them.)
  • E don get bad name.  — (ENU_31_Imo-State-Politics_DG__62, He has gotten a bad reputation.)
  • De spoil person name. (ONI_15_Gossiping_DG__98,  — (He) was smearing one's name.)
  1. Na family line.
  • For some place for Africa, na only boy pikin dem dey fit make family 'name no just carry end when their papa die.  — (NSC_Legbeti_2021. In some parts of Africa, only boys can continue the family lineage.)
  • She go born pikin wit one or several men for di community to continue di papa name.  — (bbc__88688, She had kids for different men in the community to uphold the family name.)

Verb

  • Na to give someting watin dem go dey call de ting
  • De man name im dog Rex.  — (NSC_Legbeti_2021. The man named his dog Rex.)
  • Why dem dey name hurricane?  — (bbc__100533. Why will a hurricame be named)
  • If you ask many pipo to name one player wey dey di Nigeria U20 women team, dat go be WAEC.  — (bbc__57814, If you ask people for the name of one female player in the Under 20 women team, it will be as difficult as the WAEC exam.)
  • Mah begin name di year?  — (PRT_03_Football_DG__90, Can I start naming the year ?)
  • Na im make dem name am Kaduna.  — (KAD_21_Cameroon-School_DG__27, That was why they named it Kaduna.)

Related forms

Translations

  • English: reputation, name