own

Naija

Etymology

From: English own

Pronunciation

  • óùn


Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 160
  • Frequency rank in NSC treebank: 94
  • Frequency in raw corpus: 2513
  • Frequency rank in raw corpus: 164

Adjective

  1. Na wetin be pesin ting.
    • Di one wey I get na my own, de one you get, na your own.  — (NST_cleaned__14071. What is mine is mine and what is yours is yours.))
    • Na your own.  — (NST_cleaned__41571. Its your own.)
    • Dey go your own.  — (deuber__4162, Keep on doing your part.)
  2. Na person idea or opinion about someting.
    • De organizers no gree hear dia own even though deir idea na better one.  — (NSC_Legbeti_2021. Despite their plea, nobody l.))
    • But nobody wan hear dia own.  — (bbc__51943. But no one was willing to listen to their opinion.)
  3. Na to say person no dey under another person again.
    • I don fit open my own store, e dey near waterside.  — (NSC_Legbeti_2021. I now have my own store, close to the waterside.))
    • So everyone want to be on his own.  — (JOS_11_Nigeria-Political-Issues_DG__268, So, everyone wants to be on his own.)
  4. Na person turn
    • So I no know di day wey our own tomorrow go reach o.  — (LAG_13_Our-Life_M__7, So, I don't know the day that our own tomorrow will come o.)
  5. Na how someting take get value reach.
    • I beg help me buy rice, like 200naira own.  — (NSC_Legbeti_2021. Kindly buy rice worth 200naira for me.))
    • Like fifty naira abi, hundred naira own.  — (ABJ_INF_02_Cooking-Recipes_M__52, Either fifty naira or hundred naira worth.)
    • Oya, compare ya money with senator own.  — (bbc__79800, __no translation__)
  6. Na make person like or connect wit anoder person.
    • I don dey gree your own since last year.  — (NSC_Legbeti_2021. I have been admiring you since last.))
    • Ehen na so me, and her own just click dat day wey I see her.  — (JOS_23_Wedding_DG__156, Ehe, that was how she and I just connected the first day that I saw her.)
    • As I even meet you sef, I no know my blood, wit your own just connect instantly.  — (KAD_16_Driver-Mechanic-Talk_DG__3, As I even met you, I don't know, my blood with yours just connected instantly.)

Verb

  • Make person claim someting as im own.
  • Di pesin wey own di virus fit follow you with your GPS, according to Mike.  — (bbc__1722, THe owner di virus fit follow you with your GPS, according to Mike )
  • Sey im hear sey di woman wey own dis place (im no know sey na my mama), sey di woman wey own dis place sey na only one pikin, she get. (KAD_09_Kabir-Gymnasium_MG__70, He heard that the woman who owns this place  — (he didn't know she was my mother), he said that the woman who owns this place, that she only has one child.)
  • Test your tech-biz sense: You sabi who own di social media you dey use?  — (bbc__93313, __no translation__)

Related forms

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: Something that belongs to someone, possessive determiner