parole
Naija
Etymology
From: English parole
Pronunciation
- pàról
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 2
- Frequency rank in NSC treebank: 2310
- Frequency in raw corpus: 27
- Frequency rank in raw corpus: 4544
Noun
- Na person or people doings abi ways.
- Ol'boy, say people dey smoke igbo for waka for road na normal parole here. — (NSC_Legbeti_2021. To see people smoking weeds in the open is normal.)
- You no dey know my parole again?. — (IBA_39_Easter-Preparations_DG__40, You are not familiar with the way I do things again?.)
- All dose kind parole wey e dey do no dey move me. — (Egbokhare_2020. I'm not moved by all her acting up.)
- Na when criminal wey judge send go jail no fit comot until im serve dat time finish.
- For killing Jude, dem suppose send am go jail kpatakpata without say im get parole. — (NSC_Legbeti_2021. For the murder of Jude, he ought to have been sent to life imprisonment with out parole)
- Court give am 18 months including 9 months without parole. — (bbc__87317. The court sentenced him to 18months imprisonment including 9months without parole.)
- Na when police abi security people dey waka up and down to check tings people dey do.
- Our officials don stop parole for di area, and dem dey write evritin put inside book. — (bbc__84087, The officials have stopped their patrol and are now compiling their report.)
- Na when people like flexing tings person do wit im paddies dem.
- I dey always like una parole for dat una office. — (NSC_Legbeti_2021. I admire the way you guys do things in that office.)
- E be like say some people join sake of say dem like our parole . — (NSC_Legbeti_2021. It appears people joined up because they like the way we enjoy ourselves always.)
- Na hard drugs dem like weed, cocaine.
- Police catch am wit de parole upon say she hide dem small small pack for inside yam. — (NSC_Legbeti_2021. The police caught her with the drugs though it was hidden in small packs inside tubers of yam.)
- Dem dey hide di drugs as legit product and dem dey use dia warehouse, staff plus moto take arrange di parole. — (bbc__28779. They project their illicit drugs as legit poduct while using their warehouse, staff plus cars to trade in illicit drugs.)
- Na person personal activities dem.
- You no dey feel my parole? — (NSC_Legbeti_2021. You admire my ways, dont you?)
- Anyanwu also chook mouth tok say lawmakers dey cut meeting to run dia election parole no pure. — (bbc__15963. Anyanwu told lawmakers who dodge meetings to canvass votes for the upcoming election that it was wrong.)
Synonyms
Translations
- English: court sentence dependent on good behaviour, police monitoring activities, ones way of doing things