parole

Naija

Etymology

From: English parole

Pronunciation

  • pàról


Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 2
  • Frequency rank in NSC treebank: 2310
  • Frequency in raw corpus: 27
  • Frequency rank in raw corpus: 4544

Noun

  1. Na person or people doings abi ways.
    • Ol'boy, say people dey smoke igbo for waka for road na normal parole here.  — (NSC_Legbeti_2021. To see people smoking weeds in the open is normal.)
    • You no dey know my parole again?.  — (IBA_39_Easter-Preparations_DG__40, You are not familiar with the way I do things again?.)
    • All dose kind parole wey e dey do no dey move me.  — (Egbokhare_2020. I'm not moved by all her acting up.)
  2. Na when criminal wey judge send go jail no fit comot until im serve dat time finish.
    • For killing Jude, dem suppose send am go jail kpatakpata without say im get parole.  — (NSC_Legbeti_2021. For the murder of Jude, he ought to have been sent to life imprisonment with out parole)
    • Court give am 18 months including 9 months without parole.  — (bbc__87317. The court sentenced him to 18months imprisonment including 9months without parole.)
  3. Na when police abi security people dey waka up and down to check tings people dey do.
    • Some police dey do their own parole witout say dem wear uniform ?  — (NSC_Legbeti_2021. Some police are undercover agents.)
    • Our officials don stop parole for di area, and dem dey write evritin put inside book.  — (bbc__84087, The officials have stopped their patrol and are now compiling their report.)
  4. Na when people like flexing tings person do wit im paddies dem.
    • I dey always like una parole for dat una office.  — (NSC_Legbeti_2021. I admire the way you guys do things in that office.)
    • E be like say some people join sake of say dem like our parole .  — (NSC_Legbeti_2021. It appears people joined up because they like the way we enjoy ourselves always.)
  5. Na hard drugs dem like weed, cocaine.
    • Police catch am wit de parole upon say she hide dem small small pack for inside yam.  — (NSC_Legbeti_2021. The police caught her with the drugs though it was hidden in small packs inside tubers of yam.)
    • Dem dey hide di drugs as legit product and dem dey use dia warehouse, staff plus moto take arrange di parole.  — (bbc__28779. They project their illicit drugs as legit poduct while using their warehouse, staff plus cars to trade in illicit drugs.)
  6. Na person personal activities dem.
    • You no dey feel my parole?  — (NSC_Legbeti_2021. You admire my ways, dont you?)
    • Anyanwu also chook mouth tok say lawmakers dey cut meeting to run dia election parole no pure.  — (bbc__15963. Anyanwu told lawmakers who dodge meetings to canvass votes for the upcoming election that it was wrong.)

Synonyms

Translations

  • English: court sentence dependent on good behaviour, police monitoring activities, ones way of doing things