pay

Naija

Etymology

From: English pay

Pronunciation

  • péì


Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 91
  • Frequency rank in NSC treebank: 147
  • Frequency in raw corpus: 2090
  • Frequency rank in raw corpus: 188

Noun

  1. Na salary or money person work for.
    We no dey find equal pay as doctors.  — (bbc__7216. We are not insisting on same salary with the doctors.)
    Dis decision don make many workers para, because dem prefer to collect dia pay for US dollars.  — (bbc__40451. The decision angered many workers because they preferred receiving their slary in dollars.)
    • De day I collect my firstpay ehen, I shack 5 green bottle.  — (NSC_Legbeti_2021. The day I got my first salary ever, I drank 5bottles of beer straight.)

Verb

  1. Na to give money for someting person buy or collect.
    • Pay me?  — (IBA_09_Leon-And-Amos_DG__153, Pay me ?)
    • You go help me pay bike?  — (IBA_22_School-Children_DG__178, Will you pay for my bike fare ?)
    • I go go borrow money, con pay you.  — (ENU_17_Buying-Grocery_DG__123, I will go and borrow money to come and pay you)
    • Me ma sef, I no even get money to pay.  — (ABJ_GWA_02_Market-Food-Church_DG__101, Even me, I don't have money to pay.)
  2. Na wetin no get profit or no benefit person
    • I go advice make you no start dat business because e no go pay you.  — (NSC_Legbeti_2021 I'll suggest you do not venture into that business because it is not known to be profitable.)
  3. Na to give people their money wey dem work for.
    • E tell am sey, ‘Call the workers and pay dem their money.  — (jw__37636. He ordered him to pay the workers their wage.)
  4. Na punishment wey person face for wetin e do wrong.
    • Pay fine.  — (LAG_16_Calista-Adeola_DG__101, Pay fine.)
    • As you rape your pikin so, One day, you go Pay for dis evil.  — (NSC_Legbeti_2021. You will pay for raping your own daughter one day.)
    • To help others, to pay your salary, na wahala.  — (ONI_23_Things-Don-Cost_DG__135. to help others... to pay your salary is a problem.)
  5. Na to drop money take fulfil wetin tradition and custom say make person do
    • I go pay my wife bride price last december.  — (NSC_Legbeti_2021 I paid my wife's bride price in december, last year.)
    • Him pay everyting dem ask make dem for fit make am chief but las last, dem no still give am. .  — (NSC_Legbeti_2021 He fulfilled all the requirements yet he was denied chieftancy title.)

Relative forms

Pay day, pay off

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: income or salary, To give money in exchange of something,