dirty
Naija
Alternative form
Etymology
From: English dirty
Pronunciation
Noun
- Sey someting no clean.
- Dirty just full everywhere for deir house — (The house is full of dirt.)
Translation
English: dirt, filth
Adjective
- Someting wey no clean.
- I no dey like to buy food for shop wey dirty. — (I dislike the idea of purchasing food from dirty environment.)
- All di water wey dey de village dirty no be small. — (The water in the village is very dirty.)
- Sey person mind no pure.
- Dat man ehn, im mind dirty. — ( The man's mind, is filled with filth.)
- Some people na so so dirty dirty ting dem dey tink. — ( Some people's mind are filled with all kinds of filthy thoughts..)
- Make person dey do magomago.
- Dat boy hand dirty, im ways no pure. — (That boy is involved in illegal activities.)
- Sey shayo don dey affect person.
- If your eye don dirty, no drive o. — (If you are drunk, don't drive.)
- Dat guy no get chest now, two bottle im eye don dirty. — (That guy does not have any mettle, just two bottles and he is drunk.)
Antonym
Translation
- English: dirty, filthy, drunk
Verb
- Make dem make nyamanyama dey for someting.
- Does children don dirty di water. — (The children dirtied the water.)
- I no dey like wear white because I go must dirty am. — (I don’t like wearing white because I’ll definitely stain it.)
Antonym
Translation
- English: dirty