force
Naija
Etymology
From: English force.
Pronunciation
- fɔ́s
Noun
- Wetin mean sey person must do someting.
- Na by force. — (NST_cleaned__28523, You must do it! )
- Dem wan marry by force. — (KAD_15_Money-Wahala_MG__27, They want to get married at all costs.)
- Na when de power wey someting take happen push anoder ting to happen.
- As ground draw am, she come fall wit force, all de drinks she carry for head come break. — (As she slipped, all the drink on her head hit the floor and broke.)
- Dem by force all di staff to move go di ground floor and dem dey harass pipo dia because na by force dem use to enta di building. — (bbc__4571, The staff were forced to the ground floor after gaining entrance into the building forcefully.)
- Na make group dey wey deir own na to use power do someting.
- Once all dose agbero reach here now, everywhere fit scatter because deir own na so so force. — (If the touts get to this venue, everywhere will become disorderly as they will apply violence.)
- Make person or someting dey give support or dey encourage person or someting
- My Mama na strong force for her women meeting. — (My mother is influential in the women's meeting.)
- Im say Annan na guiding force for good. — (bbc__33995, He said Annan is a source of encouragement.)
- Make person dey work for police
- My Papa dey work for force. — ( My father works with the police force.)
Related forms
Synonyms
Translations
- English: Vigour, uniformed officer
Verb
- Make Dem use power do someting.
- Di whole katakata start when some people come force deirself enter de stadium. — (The stampede happened when some fans forced their way into the stadium.)
- Court no go force pikin do wetin e no suppose do. — (The court cannot act against the will of a child.)
- Some people feel say dis one go force people wey want plenty memory to buy di new iPhone 8. — (bbc__91361, Some believe those interested in money will buy the new iPhone 8.)
Synonyms
Translations
- English: force, impose