shine
Naija
Etymology
From English: shine
Pronunciation
- ʃaɪ̂n
Verb
- Make person dey know wetin dey happen.
- Dis town, na shine your eyes town o, — (NST_cleaned__6082, In this town, you need to be smart and alert.)
- Dis mean say doctors suppose shine their eyes as dem dey treat people with Africa blood. — (bbc__40907, T his means that doctors should pay close attention when attending to Africans.)
- Make someting fine.
- Everywhere go dey shine. — (IBA_02_Igwe-Festival_MG__26, Everywhere will look festive.)
- Make someting dey bright.
- Light from God dey shine. — (jw__22231, Light from God will shine.)
- You come see something wey be like small stone wey dey shine. — (jw__36808, You see what looks like a small stone shinning.)
- Make person dey do wetin e suppose do well well.
- Na under coach Antonio Conte, na im Moses shine. — (bbc__72148, Moses became popular under the mentorship of coach Antonio Conte.)
- Anoda player wey shine na Christian Pulisic for im first competitive start for Chelsea. — (bbc__15602, Another player who gained publicity was Christian Pulisic in his first competitive start for Chelsea.)
- Make person high.
- No be only igbo dem dey take shine eye o. — (deuber__5360, Marijuana is not the only substance use for intoxication.)
- Make person dey okay con happy.
- E dey make you dey shine. — (JOS_01_People-Of-Plateau_MG__20, It makes you happy.)
- I just see as you just dey smile, dey shine teeth. — (WAZL_06_Na-Your-Health_DG__11, I can you are happy and smiling.)
Synonyms
- high, blow, happi, clean, shineshine
Translations
- English: shine, perform, intoxicate, spotless, smart