yarn
Naija
Etymology
From English: yarn
Pronunciation
- jân
Noun
- Sey person dey talk.
- Make e no for loss because if you yarn your yarn, I yarn my yarn. — (WAZL_15_MC-Abi_MG__28, So as not to waste time, because if you say whats on your mind, I will say mine.)
- But all yarn na yarn. — (NST_cleaned__41132, But all talk is talk.)
- If you hear one side of yarn judge, you no be correct judge now. — (WAZK_08_Fuel-Price-Increase_MG__54, If you listen to one side of the story and judge, you are not a good judge.)
Related Forms
Synonyms
Translations
- English: talk, story
Verb
- Make person dey talk give anoder person.
- Na so I take yarn am di tori o. — ( NSC_2020, So, I narrated the whole story to him.)
- Yarn me tori more. — (NST_cleaned__8537, Tell me more about it.)
- Hey make I, make I yarn una dis small story. — (ABJ_INF_05_On-Pidgin_M__1, Hey, let me... let me tell you a short story.)
- Eh we go siddown yarn for dat one. — (JOS_40_Travelling-On-Nigerian-Roads_DG__138, We will sit down and talk about that one.)
Related Forms
Synonyms
Translations
- English: tell, narrate