balance
Naija
Etymology
From: English balance
Pronunciation
- bálàns
Noun
- Na di remaining part of person change.
- Yesterday I forget to ask you for my balance for di thing wey I buy? — (NSC_Legbeti_2021. Yesterday I forgot to ask for my change from the stuff I paid for)
- Madam, na My balance I come collect, I no come quarrel, — ( NSC_Legbeti_2021. Madam, I do not want trouble, just pay my outstanding money.)
- MTN don pay Nigeria goment 55 billion naira wey be di balance of di 330 billion naira fine wey goment nack ontop di telecoms giant head. — (bbc__64514, __MTN has paid up its outstanding 55billion naira fine to the Government fo Nigeria.)
- Na to sidon or stand well.
- Abeg balance well make I fit sit down. — (Egbokhare_2020. Please, adjust so that I can sit down.)
- Anybody wey no balance well on top this ladder go just fall down yakata for ground. — ( NSC_Legbeti_2021. Anybody not capable of standing firm on this ladder will simply fall down flat.)
- Na money wey person dey owe person.
- We want dem to pay di balance. — (bbc__1238, __We want dem to pay us what they owe us__)
- anytime I see Mr Johnson, I go ask am for my balance wey remain. — (NSC_Legbeti_2021. Whenever i see Mr Johnson, I will collect the debt he owes me.)
- Na wetin remain for person phone to fit still make call.
- Babe, wetin be de balance wey remain for your phone. — (NSC_Legbeti_2021. Baby, what is the balance on your phone?.)
- MTN don give me awuf credit and my balance don high. — (NSC_Legbeti_2021. After MTN gave me bonus airtime, my credit increased.)
- Na money wey remain for person bank acount
- When dat alert wey I dey wait since enta my phone yesterday, my balance fear even me wey get de account. — ( NSC_Legbeti_2021. When I got the much awaited alert yesterday, I was pleasantly surprised.)
- I dey go meet dat cashier make e helep me check my balance. — (NSC_Legbeti_2021. I will ask the cashier to help check my balance.)
Synonyms
Translations
- English: to sit properly, the remaining part of a debt, change.
Verb
- Make dem do make someting dey equal.
- If dem wan balance am, shebi dem for first ask us? — (deuber__6014, If they wish to be fair, they should have consulted us.)
- Wetin you need na to balance am. — (bbc__78145. What you need is to balance things always.)
- Make person position someting where people go fit dey see am everytime.
- Peju foto of her meeting wit President Barack Obama balance ontop her desk — (bbc__80735. Peju positioned the picture she snapped with President Obama at a prominet place in her office.)
- Tel dat caterer make she balance dat jolof cooler where I go dey see am wella — (NSC_Legbeti_2021. Tell the caterer to position the cooler within view.)
Translations
- English: fairness