balance

Naija

Etymology

From English: balance

Pronunciation

  • bálâns

Play Play

Noun

  1. Di remaining part of person money wey person suppose collect.
    • Anytime I see Mr Johnson, I go ask am for my balance wey remain.  — (NSC_2021, Whenever I see Mr Johnson, I will collect the remaining part of the money he owes me.)
    • Madam, na my balance I come collect, I no come quarrel.  — (Madam, I do not want trouble, just pay my outstanding money.)
  2. Money wey remain for person bank account.
    • When dat alert wey I dey wait since enta my phone yesterday, my balance fear even me wey get di account.  — (When I got the much awaited alert yesterday, I was pleasantly surprised.)
    • I dey go meet dat cashier make e help me check my balance.  — (I will ask the cashier to help check my balance.)

Related forms

balanceancarry

Translation

  • English: balance, debt, change

Verb

    • Make person stand or siddon well.
    • Abeg balance well make I fit sit down.  — (Please, adjust so that I can sit down.)
    • Anybody wey no balance well on top dis ladder go just fall down yakata for ground.  — (Anybody not capable of standing firm on this ladder will simply fall down flat.)
  1. Make dem do make someting dey equal.
    • If dem wan balance am, shebi dem for first ask us?  — (deuber__6014, If they wish to be fair, shouldn't they have first asked us?)
    • Wetin you need na to balance am.  — (bbc__78145, What you need is to balance things.)
  2. Make person keep someting where people go fit dey see am well well.
    • Peju foto of her meeting wit President Barack Obama balance ontop her desk  — (bbc__80735, Peju positioned the picture she snapped with President Obama at a prominent place in her office.)
    • Tell dat cook make she balance dat jollof cooler where I go dey see am wella.  — (Tell the caterer to position the cooler within view.)

Synonyms

Translations

  • English: to sit/ stand properly, fair treatment