balance
Naija
Etymology
From English: balance
Pronunciation
- bálâns
Noun
- Di remaining part of person money wey person suppose collect.
- anytime I see Mr Johnson, I go ask am for my balance wey remain. — (NSC_Legbeti_2021. Whenever i see Mr Johnson, I will collect the debt he owes me.)
- Madam, na My balance I come collect, I no come quarrel, — ( NSC_Legbeti_2021. Madam, I do not want trouble, just pay my outstanding money.)
- We want dem to pay di balance. — (bbc__1238, __We want dem to pay us what they owe us__)
- Money wey remain for person bank account.
- When dat alert wey I dey wait since enta my phone yesterday, my balance fear even me wey get di account. — ( NSC_Legbeti_2021. When I got the much awaited alert yesterday, I was pleasantly surprised.)
- I dey go meet dat cashier make e help me check my balance. — (NSC_Legbeti_2021. I will ask the cashier to help check my balance.)
Related forms
Translation
- English: balance, debt, change
Verb
- Make person stand or siddon well.
- Abeg balance well make I fit sit down. — (Egbokhare_2020. Please, adjust so that I can sit down.)
- Anybody wey no balance well on top this ladder go just fall down yakata for ground. — ( NSC_Legbeti_2021. Anybody not capable of standing firm on this ladder will simply fall down flat.)
- Make dem do make someting dey equal.
- If dem wan balance am, shebi dem for first ask us? — (deuber__6014, If they wish to be fair, they should have consulted us.)
- Wetin you need na to balance am. — (bbc__78145. What you need is to balance things always.)
- Make person keep someting where people go fit dey see am well well
- Peju foto of her meeting wit President Barack Obama balance ontop her desk — (bbc__80735. Peju positioned the picture she snapped with President Obama at a prominet place in her office.)
- Tel dat caterer make she balance dat jolof cooler where I go dey see am wella — (NSC_Legbeti_2021. Tell the caterer to position the cooler within view.)
Synonyms
Translations
- English: to sit/stand properly
Verb
Translations
- English: fairness