story
Naija
Alternative Form
Etymology
From: English story
Pronunciation
stórɪ̀
Noun
- Talk wey no too make sense
- I dey ask you wetin do my motor you dey tell me story. Baba, do normal! — (I'm asking you what happened to my car and you are telling me fables. Mister, behave yourself.)
- De catch you with person wife for hotel which kind story you want talk? — (You were caught with someone's wife in a hotel, what excuse do you want to give?)
- Talk wey person dey talk because e want bobo person
- Election don reach now de go want dey tell us story, sey elephant swallow money, sey rat block door. We dey wait dem. — (Elections are here, they'll begin to tell us fables about how elephants swallowed some money and how rats blocked the door. We are waiting for them.)
- Someting wey person dey write or talk wey be sey e happen or e no happen.
- My grandmama dey sabi yarn story. — (My grandmother knows how to tell stories.)
- You don first yarn dis story, but no be as you take talk am before you dey talk am now. Shey no be lie you dey lie so? — (You have told us this story, but you are not telling it as you did before. Are you lying?)
Related forms
Synonym
Translation
- English: fables, lies, excuses, tales