chain
Naija
Etymology
From: English chain
Pronunciation
- tʃên
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 0
- Frequency rank in NSC treebank: inf
- Frequency in raw corpus: 54
- Frequency rank in raw corpus: 3028
Definition
Join join iron wey dem take de lock someting
Noun
Join join iron wey dem take de lock someting.
- Na chain de chain us. — (NST_cleaned__25891, We have been chained.)
- But e cut the chain, and e break the iron wey dem put for im leg. — (jw__35362, He broke apart the chains and iron on his leg.)
Group wey de part of someting.
- Di third important part of di chain na di distribution companies, na dem dey carri light go everibodi domot. — (bbc__38874, The distribution companies )
- De and resource-dem from all dos wey get hand and mouth inside di power value chain. — (ja102__1235, __no translation__)
- One of di horse owners, Karina Fisker talk say: when di lions chop di horse, e dey enter back as part of di food chain. — (bbc__78509, __no translation__)
Necklace
- Dat, dat chain, I no do valentine now you understand. — (LAG_14_Charles-And-Alfred-On-Music_DG__6, That...that chain, I didn't do Valentine, do you understand ?)
family
- You know I get a lot of chain, — (IBA_17_Julie-And-Danile_DG__173, You know I have a big family.)
- Na long chain na im I get na, — (NST_cleaned__8534, __no translation__)
Translations
- English: Chain
Verb
Make person take join join iron hold someting.
- Oya chain di motor for dere. — (Egbokhare_2020, Detain the vehicle there.)
Make person get habit or someting wey e no fit leave.
- As e de go, no let shak chain you. — (NSC_Odirin 2020, At this rate, you will become addicted to alcohol.)
Synonyms
Translations
- English: To hold a vehicle, to become addicted