chain

Naija

Etymology

From: English chain

Pronunciation

  • tʃên

Play Play

Noun

  1. join join iron wey dem take de lock someting.
    • Na chain de chain us.  — (NST_cleaned__25891, We have been chained with chains.)
    • But e cut the chain, and e break the iron wey dem put for im leg.  — (jw__35362, He broke apart the chains and iron on his leg.)
  2. Group wey de part of someting.
    • Di third important part of di chain na di distribution companies, na dem dey carri light go everibodi domot.  — (bbc__38874, The distribution companies are third in importance on the scale; they distribute power to everyone's home.)
  3. Small join join iron wey person dey wear for neck.
    • I never large reach those wey de buy gold chain take toast babe na, shuo!  — (I am not like moneybags who buy gold necklaces to woo a lady, the heck!)
  4. Person family people.
    • Na long chain na im I get na.  — (NST_cleaned__8534, I have a big family, you know.)

Translations

  • English: Chain, Group, Necklace, Family

Verb

  1. Make person take join join iron hold someting.
    • Na here I chain my bicycle naw. See di chain for ground!  — (This was where I chained my bicycle. See the chain on the floor.)
  2. Make person get habit or someting wey e no fit comot from.
    • As e de go, no let shack chain your life o.  — (At this rate, you will become addicted to alcohol.)
    • Dem don chain that guy destiny for village na im make e hussle no dey pay.  — (That guy has been hexed in the village that is why he does not succeed at all his endeavours.)

Synonyms

Translations

  • English: to hold a vehicle, to become addicted