chair

(Redirected from Chair)

Naija

Etymology

From: English chair

Pronunciation1

  • tʃíɛ̀

Play Play

Pronunciation2

  • tʃíà

Play


Noun

  1. Where person dey siddon put.
    • You go dey tank God sey you go beta primary school naw. Some primary schools dey wey di students dem dey carry deir own chair go school.  — (You shoud be thankful to God that you attended a good primary school. There are some primary schools where the students take their own chairs to school.)
    • When we dey grow everybody get deir own chair for dinning table and for parlour. De no born anybody make e go siddon for di chair wey be daddy own  — ( While growing up everyone had their own chair at the dinning table and in the living room. No one will dare to sit on my dad’s chair.)
  2. Person wey be sey na im get level pass for di area.
    • No be everybody chair dey follow dey laugh. No go dey shine teeth like goat.  — (The Chairman is not always amused with everyone. Don't go on laughing like a clown.)
    • Chair say make una quick come.  — (The chairman said you all should come quickly.)
  3. Person wey be oga for meeting or joinbody group.
    • • As we don talk wetin we want, e good. But we gats hear wetin chair go talk, because if e no gree, na spit we just waste o.  —  (It is good that we have said what we want , but we have to hear what the chairman has to say, because if he refuses, we would have just wasted our time.)
    • If money miss for here na only chair go fit tell us wetin happen.  —  (If some money is missing, the chairman is the best person to explain what happened.)

Synonyms

chairman, chairmo, boss

Antonyms

Translations

  • English: chair, chairman