alarm
Naija
Etymology
From: English alarm
Pronunciation
- àlâm
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 0
- Frequency rank in NSC treebank: inf
- Frequency in raw corpus: 82
- Frequency rank in raw corpus: 2363
Noun
- Di time wey dey make noise.
- Set di alarm to di time you wan your pikin to wake up, come put am ontop table wey far small from where im dey sleep. — (bbc__88055, Set the alarm and place it some distance away from the child.)
- NASA bin get only 65 minutes of beta weather to take launch, but by di time wey dem check di alarm finish, di time don pass. — (bbc__69351, NASA missed the alarm set to signal the best timing and weather to launch to space.)
- Na sey person warn person
- Dis happun afta dem fail to fly am on Saturday wen one last-minute alarm make di agency to miss dia 65-minute weather window. — (bbc__40704, It happened after they aborted the flight on Saturday because of a last-minute warning that made them miss out on the 65-minute grace period.)
- Oga Gambo explain say wen police bin get di alarm of di kidnap, dem bin pursue dem reach kwosanda junction come exchange fire with dem. — (bbc__76635, Mr Gambo said that when the police got the warning they initially chased them to Kwosanda junction and exchanged fire.)
Translations
- English: Alarm, Warning
Verb Phrase
Alarm blow
- Sey yawa gas for place or for person.
- Dis attacks dey worse more more, even with di alarm wey di governor blow. — (bbc__1958, The attacks became worse despite the fact that the governor sounded an alarm.)
- Bros, alarm dey blow for we country o. Bros, alarm dey blow for my side o. — (Egbokhare__2020, Brother, things are very difficult in our country. I am broke.)
- E take di decision to report say na false alarm and e no report to im superiors. — (bbc__45677, He did not consider the disturbing report he received as credible and so decided not to report the matter to his superiors.)
Raise alarm Make person hala sey yawa don gas.
- Authorities raise alarm on Monday 18 September. — (bbc__18071, There was bedlam raised by the authorities on Monday 18 September.)
- Na so Faruk raise alarm wey come make plenty neighbours gada for di house wey di attack for happun. — (bbc__71827, Faruk caused an uproar after he had been attacked and that attracted many neighbours to his house.)
Translations
- English: to cause bedlam