balance

Revision as of 16:04, 9 January 2021 by 102.89.3.23 (talk) (→‎Naija)

Naija

Etymology

From: English balance

Pronunciation

  • bálàns

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 6
  • Frequency rank in NSC treebank: 1007
  • Frequency in raw corpus: 85
  • Frequency rank in raw corpus: 2304

Noun

  • Na de remaining part of person change.
  • Yesterday I forget to ask you for my balance for di thing wey I buy?  — (NSC_Legbeti_2021. Yesterday I forgot to ask for my change from the stuff I paid for)
  • Madam, na My balance I come collect, I no come quarrel,  — ( NSC_Legbeti_2021. Madam, I do not want trouble, just pay my outstanding money.)
  • MTN don pay Nigeria goment 55 billion naira wey be di balance of di 330 billion naira fine wey goment nack ontop di telecoms giant head.  — (bbc__64514, __MTN has paid up its outstanding 55billion naira fine to the Government fo Nigeria.)
  • Na to sidon or stand well.
  • Abeg balance well make I fit sit down.  — (Egbokhare_2020. Please, adjust so that I can sit down.)
  • Anybody wey no balance well on top this ladder go just fall down yakata for ground.  — ( NSC_Legbeti_2021. Anybody not capable of standing firm on this ladder will simply fall down flat.)
  • Na money person owe or dem own person.
  • We want dem to pay di balance.  — (bbc__1238, __We want dem to pay us what they owe us__)
  • anytime I see Mr Johnson, I go ask am for my balance wey remain.  — (NSC_Legbeti_2021. Whenever i see Mr Johnson, I will collect the debt he owes me.)
  • Na wetin remain for person phone to fit still make call.
  • Babe, wetin be de balance wey remain for your phone.  — (NSC_Legbeti_2021. Baby, what is the balance on your phone?.)
  • MTN don give me awuf credit and my balance don high.  — (NSC_Legbeti_2021. After MTN gave me bonus airtime, my credit increased.)
  • Na money wey remain for person bank acount
  • When dat alert wey I dey wait since enta my phone yesterday, my balance fear even me wey get de account.  — ( NSC_Legbeti_2021. When I got the much awaited alert yesterday, I was pleasantly surprised.)
  • I dey go meet dat cashier make e helep me check my balance.  — (NSC_Legbeti_2021. I will ask the cashier to help check my balance.)

Synonyms

Translations

  • English: to sit properly, the remaining part of a debt, change.

Verb

  • To make someting equal.
  • If dem wan balance am, shebi dem for first ask us?  — (deuber__6014, If they wish to be fair, they should have consulted us.)
  • Wetin you need na to balance am.  — (bbc__78145. What you need is to balane things always.)
  • Make person position someting where people go fit dey see am everytime.
  • Peju foto of her meeting wit President Barack Obama balance ontop her desk  — (bbc__80735. Peju positioned the picture she snapped with President Obama at a prominet place in her office.)
  • Tel dat caterer make she balance dat jolof cooler where I go dey see am wella  — (NSC_Legbeti_2021. Tell the caterer to position the cooler within view.)

Synonyms

position

Translations

  • English: fairness