boom
Naija
Etymology
From: English boom
Pronunciation
- bûm
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 0
- Frequency rank in NSC treebank: inf
- Frequency in raw corpus: 12
- Frequency rank in raw corpus: 7251
Noun
- Na make sometin quick rise wey person benefit from.
- Dis bitcoin boom don make other online money begin show face. — (bbc__40359. The rise in the bitcoin business have led to the increase in other online businesses.)
- When my Papa begin talk about de days when Nigeria enjoy oil boom money, I go wish dem born me dat time. — (NSC_Legbeti_2021. When my Dad talk about the past when they enjoyed the fallout from oil boom , I often wish I was born in that era.)
Synonyms
Translations
- English: Flourishing increase
Verb
- Na make someting dey smell bad bad
- De room dey boom. — (Egbokhare_2020. The room is smelling.)
- De crazewoman dey just boom. — (Egbokhare_2020. The crazy woman had an offensive foul smell.)
- Na make someting dey succeed well well
- Oga John business just begin boom as im move go barrack — (NSC_Legbeti_2021. Mr John's business began thriving as soon as he relocated to the barracks.)
- Nigeria economy don begin boom again as im don dey put money for tourism. — (NSC_Legbeti_2021. The Nigerian economy began flourishing again when it invested in tourism.)
- Na make someting rise in a big way.
- Some people just want make business boom. — (bbc__91375. Some persons just wish business would increase rapidly)
- E get de time wey prostitution take boom wellwell for dis Naija. — (NSC_Legbeti_2021. There was a time when prostitution thrived in this country.)
Synonyms
Translations
- English: Ooze, Thrive