comot

Revision as of 21:27, 16 August 2020 by TellaSamson (talk | contribs) (→‎Verb)

Naija

Etymology

Borrowed from English come out

Pronunciation

  • comot*

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 135
  • Frequency rank in NSC treebank: 111
  • Frequency in raw corpus: 3975
  • Frequency rank in raw corpus: 97

The word is used more in written texts than orally.


Verb

comot:


  1. make person waka leave a place
    Comot!  — (IBA_42_Barrabas_DG__159, Leave !)
    I wan comot.  — (ABJ_GWA_10_Steven-Lifestory_MG__184, I want to leave.)
    Make dem carry dem comot if e dey possible.  — (NST_cleaned__2040, __no translation__)
    Many of dem waka comot as im dey give di speech.  — (bbc__28587, __no translation__)
    Aproko wey dey say Naija international midfielder wey be John Ogu fit piante comot for Israel wen season end after e don spend five years.  — (brila.cleaned__173, __no translation__)
    Charles Sirleaf wey be di former central bank govnor and pikin of former President Ellen Johnson Sirleaf na one of di officials wey no fit comot di kontri as e be so.  — (bbc__54468, __no translation__)
  2. na make person (woman) drop engine
    Some women now, if de get belle, de go say if de take water leaf, di belle go comot because deir belle soft.  — (BEN_07_Child-Spacing_DG__115, Some women now, if they are pregnant, they say that if they eat water leaf they will abort because their belly is soft.)
  3. to con recover from someting
    According to Mr Aremu, Nigeria no go fit comot from 'economy recovery' if dem no dey pay workers well.  — (bbc__11502, __no translation__)
  4. make person remove someting
    But to dey fair to Mr Prakash, one of im hand no comot for di steering as dem dey drive.  — (bbc__23570, __no translation__)
    If our own die, we go dey comot am dey put am for our room.  — (NST_cleaned__22539, __no translation__)
    If any of dem don dey get this kind mind or dey ‘eye’ person wey no be their husband or wife, make dem quick comot am for mind.  — (jw__45136, __no translation__)
  5. make someting show face
    True true, the sun no comot for the whole day until Israel people finish Canaan and their soldier.  — (jw__9332, __no translation__)
    dem come drive everybody comot later now  — (deuber__2163, __no translation__)
    Nadal bin crash comot Madrid Open semi-final after e fall yakata 6-4, 2-6, 6-3 to Greek world No 9 wey be Stefanos Tsitsipas, and dis one follow another last-four yakata falling for im last two events for Barcelona and Monte Carlo.  — (brila.cleaned__1118, __no translation__)
    Why Joshua go tell Jehovah sey make sun no comot when that kind thing never happen before?  — (jw__9330, __no translation__)
  6. na make person bone
    But make we get am for mind sey, congregation no go comot eye for this kind matter even if e no dey too happen.  — (jw__37910, __no translation__)
    No comot eye for anything wey you dey learn, even if e be like sey e small.  — (jw__23455, __no translation__)
  7. make person forget someting
    Di study show say even though men dey comot dia mind from sex as dem dey old, na relationship wey dey old pass one year dey make sex tire women most times.  — (bbc__38677, __no translation__)
  8. make person no dey dey involve for someting
    Na im make dem no quick comot hand from war matter.  — (jw__12658, __no translation__)
    Na later she come comot im hand small-small as she bin dey fear say she go vex am.  — (bbc__71319, __no translation__)


Derived forms

  1. Di lawmakers feel say her comot plan no dey give UK advantage over Europe.  — (bbc__35690, __no translation__)
    Di lawmakers feel say her comot plan no sweet for di UK, say na EU e dey favour pass, so dem gada di 48 votes dem need to press di leadership challenge button.  — (bbc__35691, __no translation__)


Synonyms

  • disappear, leave 0.57 1444, run

Antonyms

  • enter 0.67 2952, enta 0.58 1907, recover 0.57 235, plus including, show face, land, waka come

Translations

  • English: no definition, get_out