compound
Naija
Etymology
From: English compound
Pronunciation
- kɔ́mpàùnd
Noun
- Di place wey house wey person get dey or wey house wey person dey rent from person dey.
- E dey inside deir compound. — (He/she is in their personal house.)
- Amaka just pack in come di compound. — (NST_cleaned__38553, Amaka is a new tenant in the building.)
- All of my compound people dem dey buy soap for my hand. — (LAG_37_Soap-Making_MG__69, All the tenants in my building purchase soap from me.)
- Now, and na for where I grow up for face me I face you compound for Kaduna for Kakuri Kaduna, na dere I from learn all of dem. — (NST_cleaned__14226, I learnt all of that in the single-room apartment building I was raised in, in the Kakuri area of Kaduna.)
- Space wey remain after de don build house ontop land finish. / Di area wey surround house.
- My house and compound dey clean? — (jw__15444, My house and its surroundings are well kept.)
- The gunmen shoot some cars wey dey for EFCC compound. — (bbc__93470, Gunmen riddled some of the cars parked in the premises of EFCC with bullets.)
- Di oga talk dis word o by di time wey im carry waka come look di working property wey dey for F.R.C.N. compound for Lagos here. — (deuber__1774, The boss made the statement while on inspection of the property within the F.R.C.N. premises in Lagos.)
- Di area wey people for village wey be di same family build deir house or where people wey be family settle put.
- You see dat mango tree? From dere go reach dat palm tree for down down, na our family compound be dat. —
You see that Mango tree? From there all the way to the palm tree further down is our family compound.)
Translations
- English: building,compound, premises