cook
Naija
Etymology
From: English cook
Pronunciation
- kûk
Frequency
- Frequency in NSC treebank: 70
- Frequency rank in NSC treebank: 186
- Frequency in raw corpus: 341
- Frequency rank in raw corpus: 893
Noun
- Na person wey dey prepare food.
- Make una no turn me to una cook for dis house. — (NSC_Legbeti_2021. I will not become a cook for anybody in this house.)
- All di levels wey I get na because na me be de cook for governor. — (NSC_Legbeti_2021. The fact that I am the governor's cook has granted me privileges)
- She do cook, waitress, sex-worker, dancer, actor, journalist, singer and teacher work. — (bbc__88556. She is a cook, a waitress, a dancer, an actor, a journalist, a singer and a teacher.)
- Life tire di cook dem. — (bbc__63868. The cooks are frustrated)
Translations
- English: a cook
Verb
- Na make person prepare food.
- You sabi cook? — (ABJ_GWA_05_Tailoring_DG__32, Do you know how to cook?)
- Make e say e dey teach my wife how to cook. — (KAD_06_Cooking_DG__67, So that she will say she is teaching my wife how to cook.)
- Di soup wey I like to cook, na im be banga soup. — (BEN_08_Egusi-And-Banga-Soup_MG__45, The soup that I like to cook, is banga.)
- You know how de take dey cook di soup? — (ABJ_GWA_02_Market-Food-Church_DG__54, Do you know how they prepare the dish?)
- When dem come back, na di woman go cook. — (BEN_01_Woman-Life-No-Easy_M__25. When they come back home, it's the woman who will cook.)
- E no be everyting your wife fit cook. — (KAD_06_Cooking_DG__56, It's not everything your wife can cook.)
- So wetin you sabi cook well? — (ENU_18_Onugbu-Soup_DG__1. So what do you know how to cook well?)
- Na make person do juju to make am strong.
- Dem don cook de moto park chairman done. — (NSC_Legbeti_2021. The park chairman has been fortified with charms.)
- I wan go cook myself first before I enter politics for dis country. — (NSC_Legbeti_2020. I want to fortify myself first before goint into politics in this country.)
č
Serial Verb
- We cook, we eat. — (NST_cleaned__30704. We cook and eat.)
- I cook, I give dem, — (NST_cleaned__16845. I cooked and shared.)
- Dey cook, dey give am. — (ONI_15_Gossiping_DG__177. They Cooked and shared.)
Translations
- English: cooking, charm