dash
Naija
Etymology
From: English dash
Pronunciation
- dâʃ
Noun
- Wetin person give person wey di person no go pay put or give am anyting.
- No be dash. — (NST_cleaned__25170, It is not free.)
- Dat car wey e give una neighbour, na dash? — (NSC_2021, The car he gave your neighbour, was it free?)
Translations
- English: gift
Verb
- Make person give person someting wey di person no go pay put or give am anyting.
- I dash am money. — (Egbokhare_2020, I gave him/her money.)
- Other people dey dash pikin wey no get mama and papa money. — (jw__30181, People give alms to orphans.)
- Sabi pipo bin don do 39 womb transplant, for some dem use live donors including mama wey dash dia daughters dem dia own wombs. — (bbc__86546, Experts have carried out 39 womb transplants and some of the live donors were mothers who willingly donated their wombs to their daughters.)
- America Attorney General Jeff Sessions wey fire am talk say dem find out say im dey dash vital information and im do investigators dem wuru-wuru. — (bbc__14693, Jeff Sessions, the American Attorney General, accused him of leaking top secrets and lying to the investigators.)
- Authorities nack am charge say im carry dash Grace di degree. — (bbc__18064, He was accused of falsely awarding the degree to Grace. )
Synonyms
Translations
- English: gift