deliver

Naija

Etymology

From English: deliver.

Pronunciation

  • dìlívà

Play Play

Noun

  • Daily, weekly or monthly money wey people dey return for someting wey dem buy on credo.
  • How much be im deliver?  — (How much does he receive in returns?)
  • Im dey do daily deliver for di keke wey e bin buy.  — (He pays daily for the tricycle he bought.)

Translations

  • English: a daily, weekly or monthly returns by a commercial cab, motorcyclist or any hire purchased equipment.

Verb

  1. Make person born pikin.
    • Na so we con go hospital wey she deliver.  — (ONI_18b_Na-So-Belle-Don-Shoot_M__50, We went to the hospital where she gave birth.)
    • Mama Osaro don deliver anoder boy.  — (Mama Osaro has given birth to another boy.)
  2. Make dey comot evil spirit for person body.
    • Dem need to deliver dat boy for church o.  — (They need to exorcise that boy in the church.)
  3. When person dey do im work well.
    • E say coaches suppose waka round the country to find better young strikers wey dey hungry enough to deliver the goals.  — (brila__221, He said the couches were suppose to scout for young strikers who are hungry enough to deliver the goals.)
    • Di guy dey deliver. Na me tell you. Give am di job.  — (The guy does his work well. Trust me. Give him the job.)
    • Nobody ask you, but na you just open mouth waaa say you go fit do am. Oya, time don reach to deliver you dey make mouth like pikin wey dey suck breast.  — (NSC_2021, Nobody requested anything from you; you put yourself forward, boasting that you could do it. Now, it’s time for you to acutally do it and you are saying gibberish.)
  4. Make dem bring someting come for person or someting.
    • Do part payment or pay after dem deliver.  — (bbc__43066, You pay part of the money or pay fully when it gets delivered to you.)
    • But dis no be dia only work. Dem go pack meat for inside basin come carry am for dia head to deliver to customers wey come buy meat from di butchers.  — (bbc__22471, The only job is to deliver meat to customers who bought from the butchers.)
    • You no go fit be anyting naw. Common polling booth wey dey front of your papa house, you no fit deliever. Na di full state you go con fit deliver. Bros abeg put eye for your lawyer business, abeg.  — (You can’t be anything. You could’t perform the simple task of winning the polling booth in front of your father’s compound. Will you then be able to deliver the entire state? Sir, please focus on your legal career.)

Synonyms

Translations

  • English: exorcise, deliver, perform