discharge

Revision as of 22:33, 28 February 2024 by Emeka (talk | contribs) (→‎Pronunciation)
(diff) ← Older revision | Latest revision (diff) | Newer revision → (diff)

Naija

Etymology

From: English discharge

Pronunciation

  • dɪ̀stʃɑ̂dʒ

Play


Verb

  1. Make dem tell person wey dey for somewhere say make e comot for di place, sey make e dey go house.
    • After di operation, wey e don dey well im doctors con discharge.  — (After the surgery, he was discharged by his doctor since he was recovering well.)
    • Oga kpatakpata for our station don discharge our friend because of di accident wey e get.  — (The inspector General at our station has discharged our friend of his service as a result of the accident he had.)
    • If person show imsef sey e be jagajaga person, discharge comot for di place.  — (If a person shows himself or herself to be nonsensical, leave the place.)
  2. Make di battery of something wey person dey charge no con dey charge as e suppose to charge normal normal.
    My phone just dey discharge as di charger don spoil.  — ( My phone keeps discharging since the charger is bad.)
  3. Make person comot for somewhere quick quick.
    • Na because your babe call you make you discharge like dat?  — ( Was it because your girlfriend called you that you left in a hurry?)
    • If you go dat side, once you see somekind men wey you no know, discharge sharply.  — (If you go there, once you see suspicious looking people you don't know, leave there very quickly.)
  4. Make dey try make person wey dey with am comot or make e no give am someting or buy someting for am.
    • You don discharge me tire. Today, I dey follow you go house. Noting wey you want tell me.  — (You have deceived and shaken me off too many times. Today, I will follow you home. There's nothing that will make me change my mind.)
    • No be must sey you must buy drink for men, once once still discharge dem.  — (It's not compulsory that you have to buy drinks for the guys, sometimes, excuse yourself.)

Translation

English: discharge, leave in a haste, shake off, excuse