drag

Naija

Etymology

From: English drag

Pronunciation

  • drâg

Play Play

Verb

  1. Make person or someting carry person or someting go anoder place; or Make person carry person carry person or someting join matter.
    • Why una wan drag Buhari inside Benue state mata?  — (bbc__75912, Why do you all want to get Buhari involved in Benue State issues.)
    • Amnesty also accuse goment for Nigeria unto say dem no try to drag pipo wey get hand inside insecurity mata go court.  — (bbc__14844, Amnesty is also accusing the Nigerian Government because they are not making any attempts to take people who have been said to cause insecurity to court.)
  2. As person dey do make e get someting wey anoder person want still get.
    • Nigeria: 3 young pipo wey wan follow Buhari drag for president.  — (bbc__74218, Nigeria: Three young people who want to contest with Buhari for the presidency.)
    • As if dat one no do, wahala dey shake di Nigeria Football Federation on top two factions - Amaju Pinnick for one corner and Chris Giwa for di oda - wey dey drag who suppose control football for Nigeria.  — (bbc__17183, As if that is not enough, there is an issue in the Nigerian Football Federation, from two factions, Amaju Pinnick in one camp, and Chris Giwa in the other camp, they are competing for control of the Football Association.)
    • De go come begin drag remote.  — (KAD_03_Why-Men-Watch-Football_MG__10, Then they will start fighting over who holds the remote.)
    • Dem dey drag who go carry first.  — (Egbokhare_2020, They are competing for first position.)
  3. Make people dey curse and yab deirsef.
    • APC primaries: see how Ambode and Sanwo-Olu take drag diaself  — (bbc__10867, APC primaries: Take a look at how Ambode and Sanwo-Olu are berating each other.)
    • Body go tell am, im go dey drag who pass am.  — (He will face the consequences, he decided to go head to head with someone above his level.)
    • As you go expect, pipo for social media begin drag oga Shogunle for wetin im tok.  — (bbc__17538, As you will expect, people on social media)
  4. Make people dey talk disame matter up and down, sotay, e no end.
    • We don dey drag di issue since morning.  — ( We have been arguing the issue since morning.)
    • Come if you go come, no dey drag matter.  — (Come if you want to, don't prolong the issue.)

Translations

  • English: involve, compete, argue, berate