hala

Naija

Alternative forms

Etymology

From English: holler

Pronunciation

  • hálà

Play Play

Verb

Transitive

  1. Make de dey hail who be im paddy.
    • Oga, all your boys dey here dey hala you greetings.  — (NSC_Legbeti_2020. Boss, your boys are greeting you.)
    • Ben, hala your friend now.  — (NSC_Legbeti_2020. Ben, send a shout out to your friend now)

Intransitive

  1. Make person dey talk dey shout join.
    • Di thing be say, as im vex enter field to hala for di referee, im carry gun for di side of im jeans trouser.  — (bbc__38844, The thing is that he entered the field to shout at the referee with a gun hidden in his jean trousers.)
    • Goment charge her wit murder - but afta pipo hala, dem stop di prosecution and she come fit focus on her pikin recovery.  — (bbc__54443, Although the government charged her with murder, people's loud protested stopped further prosecution and she was now able to focus on nursing her baby to recovery)
    • E come hala again.  — (katakata__10. He came ranting again.)
    • I sabi hala .  — (NSC_Legbeti_2020. I can yell.)
    • Why everybody just dey hala for me like say I kill person.  — (NSC_Legbeti_2021. Why is everyone screaming at me like i killed someone?)
  2. Make person sabi dey quarrel.
    • Any man wey marry woman wey too dey hala no go live long.  — (NSC_Legbeti_2020. Any man married to a troublesome woman will hardly live long)
    • Dat compound, people sabi hala everyday.  — (NSC_Legbeti_2020. In that compound, people quarrel everyday.)
  3. Make person follow person quarrel.
    • Di NLC don hala on top Baba Buhari o.  — (IBA_32_Tori-By-Samuel_MG__14, The NLC has called out President Buhari.)
    • I hala give my friend when she do anyhow.  — (NSC_Legbeti_2020. I called out my friend when she offended me.)


Synonyms

Translations

  • English: yell, shout. quarrel