hand

Naija

Etymology

From English hand.

Pronunciation

  • hánd

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 90
  • Frequency rank in NSC treebank: 151
  • Frequency in raw corpus: 2767
  • Frequency rank in raw corpus: 146


Definition

  • Part of person body wey join shoulder wey person fit use hold or measure tings.
  • Sey dem give person something.

NOUN

  1. Part of person body wey join shoulder wey person fit use hold or measure tings.
    • As in cre~, fire con burn dis my hand,  — (ABJ_GWA_05_Tailoring_DG__3, Fire burnt this my hand.)
  2. Na sey person follow for something or join do something
    • E dey people hand to choose.  — (jw__7602, __It's people's freedom to choose.__)
  3. Wetin dem dey use dey measure tings
    • Na one hand of rope I buy  — (NSC_Ajede_2020, It's a hand measurement of rope that I bought)
  4. Wetin person fit control/hold
    • Even my younger broder now wey want, wey dem give admission, mstchew hm na God hand di ting dey.  — (ENU_03_School-Fees-And-French-Exams_DG__120, Even my younger brother now who wants... who was given admission, hm, it is in God's control)
    • Na to protect Jehovah people, especially from Babylon hand.  — (jw__42768, It's to protect Jehovah's people especially from Babylon's hold)

Derived forms

  1. Boko Haram people hand
    Di minister con come outside to yarn sey di same formula wey government use, wey de take release di eighty two Chibok girls wey de release so, plus di even before, before twenty one, na im de go still use take release di one wey be sey e remain for inside Boko Haram people hand as de take rub mind wit government and oda people,  — (WAZL_12_Chibok-Girls_M__7, The minister then came outside to say that the same formula that Government used to release the eighty two Chibok girls that were just released, plus the twenty one, that is what they will still use to release the ones that are remaining in the hands of Boko Haram, as they discussed with the government and other people.)
  2. monkey hand
    Meh you comot monkey hand for soup o before e turn to woman hand.  — (ENU_12_Social-Life_DG__21, They should remove the monkey's hand from the dish before it turns into a woman's.)
  3. woman hand
    Meh you comot monkey hand for soup o before e turn to woman hand.  — (NST_cleaned__4263, __no translation__)
    If you turn to woman hand, deir own, all of dem na de same thing,  — (ENU_12_Social-Life_DG__22, If you turn to a woman's hand, their own, all of them, it's the same thing.)
  4. hand grandma…
    Na two hand grandma… ,  — (NST_cleaned__8159, __no translation__)
  5. pikin hand
    So na small pikin hand fit enter, and na agbalagba go put hand.  — (IBA_05_Cobbler_DG__59, So, it's only a child's hand that can enter, but it is an adult that will put his hand.)
    How e go do you for body if you see person wey put im pikin hand for fire because the pikin do bad thing?  — (jw__42532, __no translation__)
  6. hand work
    When you learn work, hand work,…  — (NST_cleaned__13967, __no translation__)
    all of us na your hand work.’— Isa.  — (jw__5710, __no translation__)
  7. man hand
    Na so I collect for di man hand before di man go.  — (ONI_16_Thief_DG__167, That was how I collected it from the man's hand before the man left.)
    Drawing of man hand wey dey give Afghan currency to anoda pesin  — (bbc__43629, __no translation__)
  8. hand mill
    If you get ehn dis mstchew hand mill, eider you break am for di handmill, or if you get local stone, you use local stone break am into smaller pieces.  — (KAD_11_Edikaikong-Gbegiri_M__106, If you have ehn this mstchew hand mill, either you break it with the hand mill or if you have a local stone, you use local stone to break it into smaller pieces.)
  9. person hand
    All dose vulganizers just dey collect money for person hand hundred, hundred naira hundred, hundred naira.  — (NST_cleaned__22905, __no translation__)
    To make person hand strong, fit mean to make im mind come down, to support am, or to give am power to do something.  — (jw__24085, __no translation__)
  10. people hand
    wey no wan let am reach di poor people hand  — (deuber__502, __no translation__)
    Na im go save Israel people from Philistine people hand.  — (jw__23526, __no translation__)
  11. second hand
    So na second hand im go con carry.  — (NST_cleaned__34283, __no translation__)
    When you don become second hand, when you don become second hand.  — (NST_cleaned__34341, __no translation__)
  12. senate hand
    sey senate hand no dey inside di tori wey de fly sey de wan increase fuel price for...  — (NST_cleaned__37155, __no translation__)
  13. papa hand
    Because she suffer for her papa hand.  — (WAZP_07_Imonirhua-Lifestory_MG__71, Because she suffered at the hands of her father.)
  14. oga hand
    Ah see as I dey di time wey I dey for my oga hand.  — (NST_cleaned__38472, __no translation__)
    Chuba Okadigbo o, some olokpa dem o just go land dere for one early morning o to make sure say dem go collect di , di thing wey show di sign of power, abi di title, abi di staff of office wey dey for di oga hand for im own house gangangan.  — (deuber__1804, __no translation__)
  15. sey hand
    Because im head, e be like cow head, im leg, e get tail like monkey, im hand, e be like sey na e be like human being hand, im body, e be like... be like sey na pig body.  — (IBA_04_Alaska-Pepe_MG__83, Because its head, it was like a cow's head; its leg, it had a tail like a monkey's; its hand, it was like that..., it was like that of a human being; its body, it was like... it was as if it was a pig's body.)
  16. top hand
    And in fact sey make people... make customers go dey carry di law put on top deir hand especially when things no dey favour dem.  — (WAZL_03_News-On-Gmns_MG__36, And in fact, that people... that customers take things into their own hands, especially when things don’t favor them.)
  17. pipo hand
    Market pipo fit increase dia price if di new minimum wage enta pipo hand  — (bbc__65820, __no translation__)
    Na di scam e run comot money from plenti pipo hand since wen im be 17 years old.  — (bbc__70532, __no translation__)
  18. pesin hand
    No result sheet alias form EC8A dey for any wrong pesin hand  — (bbc__5423, __no translation__)
    Facebook say dem dey send notice to user wey go tell dem weda dia data don fall enta pesin hand.  — (bbc__48434, __no translation__)
  19. hand Hiace bus
    Victoria Nyeche I go need at least two second hand Hiace bus, print posters and billboards for at least each ward to do my campaigns  — (bbc__97684, __no translation__)
    For instance, to campaign for my federal constituency I go need at least two second hand Hiace bus, print posters and billboards for at least each ward to do my campaigns, wetin I don tok alone go cost nearly 20 million Naira Victoria Nyeche, di APC Candidate for Port Harcourt Federal Constituency One tok.  — (bbc__2931, __no translation__)
  20. hand basin
    I dey enter shower quick-quick‚ once every three days‚ and for the rest I dey wash inside hand basin.  — (bbc__3358, __no translation__)
  21. iron hand
    I really give di military and police order to use iron hand.  — (bbc__3986, __no translation__)
    Di former Sudan president enta power for 1989, im rule one of Africa largest country until 2011- di year wey South Sudan break out with iron hand.  — (bbc__34679, __no translation__)
  22. APC hand
    Na so-so propaganda full APC hand - dem don dey manipulate foto and words tey-tey, tok Paul Ibe, wey be media adviser to Mr Abubakar.  — (bbc__5231, __no translation__)
  23. hand side
    E go back to heaven go sitdown for God right hand side  — (jw__8644, __no translation__)
    The police dey chase people…police dey left and people dey the right hand side.  — (bbc__6288, __no translation__)
  24. SARS officers hand
    Tope say na early dis year na im e jam palava for SARS officers dem hand: dem come say make I call my parents pay bail of N150,000. Na luck say my friend call one NGO wey come pay 25,000 naira.  — (bbc__6433, __no translation__)
    Tope tell BBC News Pidgin say na early dis year na im e jam palava for SARS officers dem hand: dem come say make I call my parents pay bail of N150,000....dem beat me...my ear pain me for two days, na wetin im talk.  — (bbc__6436, __no translation__)
  25. court hand
    We don arraign six of dem for court and now evertin dey di court hand to decide weda dem go grant dem bail or not. oga Elkana tok.  — (bbc__6834, __no translation__)
    Where e be sey proceedings wey di who be di papa of pikin or who be di mama of pikin na di court hand e dey to talk based on the proceedings, e dey get presumption of law sey di person dey legitimate if de give direction under section 63 for dis Act in di proceedings ;  — (hildrights__931, __no translation__)
  26. migrant hand
    From nowhere, one soldier use machete cut di migrant oda hand and ask am say, 'Which one dey pain you pass now?'  — (bbc__8281, __no translation__)
  27. regulator hand
    E dey for di regulator hand' to weed those wey no good out, im explain.  — (bbc__8795, __no translation__)
  28. school hand
    I don suffer for di school hand' sef'  — (bbc__8932, __no translation__)
  29. Boko Haram hand
    Dis one dey come as tori bin fly upandan say Leah don die for Boko Haram hand.  — (bbc__42080, __no translation__)
    But more than 100 schoolgirls still dey for Boko Haram hand, and nobodi know where dem dey.  — (bbc__23012, __no translation__)
  30. tori hand
    But, dis resolution weh committee write fall for tori people dia hand, and deh di spread am for social media say Cameroon don sack Broos.  — (bbc__23846, __no translation__)
    Police Investigation Unit wan carri am go court on top tiff of secret documents wey no suppose dey dis tori pesin hand' on to say e fit disturb di peace, scatta law and order even cause katakata inside di kontri'.  — (bbc__9236, __no translation__)
  31. INEC hand Activists
    We dey suffer to get our PVC' - Nigerians INEC PVC deadline: Pipo like fire brigade #OneVoiceNigeria: Ten million PVC still dey INEC hand' - Activists  — (bbc__9356, __no translation__)
  32. Islamist militants Boko Haram hand
    AFP Di mama of di remaining Dapchi school girl wey still dey Islamist militants Boko Haram hand don tell tori pipo, say nobody for Nigeria goment don visit di family since her pikin miss.  — (bbc__9874, __no translation__)
  33. Nigeria hand
    Mr Kanu wife, Uchechi, say her husband dey Nigeria goment hand  — (bbc__68323, __no translation__)
    Den di money go come back to Nigeria hand after some weeks wey dem don agree on top.  — (bbc__30027, __no translation__)
  34. police hand
    Di 27-year old dey police hand now as im be suspect.  — (bbc__30444, __no translation__)
    Di driver dey Marine police hand as im go report imsef.  — (bbc__59566, __no translation__)
  35. hand sign
    Di 'OK' hand sign don become di latest hate symbol according to new report by di Anti-Defamation League .  — (bbc__30274, __no translation__)
    According to di ADL, di link of di OK hand sign to white nationalism bin start as fake news wey some users of one website 4chan, wey lie say di sign get links to white supremacy.  — (bbc__11734, __no translation__)
  36. factory hand
    For Ghana, dis former factory hand for Ashaiman, dey use dis all new innovation for di country recycle all plastic waste for di roads den landfill sites into pavement blocks.  — (bbc__12298, __no translation__)
    For Ghana one former factory hand for Ashaiman, Nelson Boateng start some all new innovation for di country as he dey recycle all plastic waste for di roads den landfill sites into pavement blocks.  — (bbc__50179, __no translation__)
  37. hand informate
    Acting tok-tok pesin for di EFCC, Tony Orilade, confam to BBC Pidgin say wen dem get first hand informate about dis yahoo-yahoo training school, dem come go undercover to burst di operation.  — (bbc__12324, __no translation__)
  38. INEC hand
    Adamawa suppose dey part of dem but one court order don tie INEC hand ontop di mata.  — (bbc__12399, __no translation__)
    She say dem go do di collation and announcement of results in a transparent way but she say dem no sabi who dey win but all di results dey intact for INEC hand.  — (bbc__88858, __no translation__)
  39. Atlantic sign' hand
    Akinwunmi Ambode Presido Buhari say wetin im do for di Eko Atlantic Project na to 'open sign' Presido Muhammadu Buhari hand don full in di last two days, as im dey correct pipo upandan for twitter about wetin im do and no do.  — (bbc__13559, __no translation__)
  40. mama hand
    Although dem no sure, di sabi pipo wey rescue Pony say dem collect her from her mama hand wen she be pikin and she spend like six years as prostitute for di hotel.  — (bbc__14455, __no translation__)
  41. government hand
    August - Transitional government hand over power to di General National Congress, wey dem elect for July.  — (bbc__17944, __no translation__)
    Ukan Kurugh wey dey among area people wey don dey respond to di tragedy say di people never see government hand.  — (bbc__97073, __no translation__)
  42. women hand
    No be small yabis she chop especially for women hand wey she say yab her pass men.  — (bbc__75027, __no translation__)
    BBC 100 Women don take eye analysis am, come see say Hollywood dey fall women hand as e concern dia mata.  — (bbc__18215, __no translation__)
  43. EFCC hand
    Babachir wey bin dey EFCC hand since Wednesday, waka comot on bail on Friday evening.  — (bbc__18895, __no translation__)
    Justice Peter Afen adjourn di mata to di June 3 for di hearing of dia bail application and order dem make dem still dey EFCC hand till dem get dia bail.  — (bbc__61605, __no translation__)
  44. hand day
    But afta all di event on Tuesday, na big question wey many pipo go dey ask go front how June 12 fit become di new hand ova day for evri goment.  — (bbc__21729, __no translation__)
  45. countries hand
    But di 1951 Convention no spell out how countries go use take determine whether person wey dey seek refugee status for dia country meet di criteria, na countries hand dat one dey to determine am.  — (bbc__22063, __no translation__)
  46. pastor hand
    But fans begin para wen video wey pipo dey share for social media show say di pastor hand press di musician breast as im dey hold her.  — (bbc__22687, __no translation__)
  47. goment hand
    Ngom say dis fight no be di type wey dem fit leave for goment hand or international partners.  — (bbc__72835, __no translation__)
    Im tink say if plenti pipo know about your wahala by say you put am for media, e fit move goment hand.  — (bbc__59621, __no translation__)
  48. kidnapper hand
    But some people still think say na correct thing say another Chibok girl don comot kidnapper hand go back dia house.  — (bbc__23494, __no translation__)
  49. Bashir hand
    But thousands of protesters still camp outside di Defence Ministry, dey demand make military rulers wey replace Bashir hand over power to civilians.  — (bbc__23554, __no translation__)
  50. bank hand
    CBN tell bank customers make dem no fear to report any mata wey don pass two weeks for any bank hand.  — (bbc__24040, __no translation__)
  51. security people hand
    Chief Horsfall say for di security people to still allow people wey suppose dey use cane pursue cow begin use AK-47 gun attack people inside di country, say security people hand dey inside.  — (bbc__25300, __no translation__)
  52. goalkeeper Charles Swini hand
    De Lions play beta dan for Comoros Island weh deh struggle for draw 1-1, but if de midfield and defence work beta, attack no work fain as na only deh shoot straight for goalkeeper Charles Swini e hand for first half.  — (bbc__27319, __no translation__)
  53. rain hand
    Dem also post photo dem of di kain scata-scata wey di state carri eye see for di rain hand on Monday.  — (bbc__28213, __no translation__)
  54. oga presido hand
    Dem fit recommend case but all di action dey for oga presido hand.  — (bbc__29087, __no translation__)
  55. second hand clothes
    Dem tok say dem dey import di second hand clothes and jackets and pipo wey no get money to enter boutique dey buy from dia hand.  — (bbc__29888, __no translation__)
  56. hand gloves
    Dey equally no wear hand gloves, boots and something to take to cover dia nose from dust.  — (bbc__30221, __no translation__)
  57. hand basins
    Di importers abi smugglers, pretend say na wash hand basins dey inside di ship.  — (bbc__35247, __no translation__)
    Di Customs Service say di smugglers carry di guns entre di country under pretence say na wash hand basins dem dey import.  — (bbc__31082, __no translation__)
  58. group hand
    She enta di militant group hand afta dem kidnap her comot her village for Borno state.  — (bbc__88610, __no translation__)
    Di Federal Government bin talk say na 101 girls be di total number of girls wey Boko Haram release but five of dem die for di group hand.  — (bbc__31295, __no translation__)
  59. hand post
    Di Nigerian International wey move go Everton dis summer from Arsenal come in for second half and almost score for im team, but im short hit di right hand post.  — (bbc__32037, __no translation__)
  60. All Progressive Congress hand
    Di PDP tok-tok pesin tok dis one as di party launch dia campaign council wit more than 150 members wey dia work go be to come up wit beta strategy to collect power from di ruling All Progressive Congress hand for 2019.  — (bbc__32161, __no translation__)
  61. Kano Hisbah Board hand
    Di case don enta Kano Hisbah Board hand  — (bbc__33449, __no translation__)
  62. hand sponsor
    Di concert, wey di Ivorian government join hand sponsor, happun for Abidjan on Friday just before di funeral Thousands of fans don gada for Ivory Coast capital Abidjan to pay tribute to musician DJ Arafat.  — (bbc__33738, __no translation__)
  63. hand washing
    Dis fear push am to start campaign to gather money to buy solar lamps and hand washing machine give im neighbours.  — (bbc__34382, __no translation__)
  64. wayo hand
    Di officials chop suspension sake of say dem allegedly award contract of N25 billion wit wayo hand.  — (bbc__36671, __no translation__)
  65. Swift hand
    Di one wey catch pipo eye na for di 2009 MTV VMA when im nearly collect di Best Female Video award from Taylor Swift hand 2009, come tok say na Beyonce suppose win am.  — (bbc__36760, __no translation__)
  66. striker hand
    Di organisers of change.org petition dey claim say di defender know wetin im dey do wen im cari di striker hand put under im armpit, wey make am dislocate im shoulder.  — (bbc__36888, __no translation__)
  67. army hand
    PIUS UTOMI EKPEI Zaki Biam na anoda community wey don hear am for army hand  — (bbc__80203, __no translation__)
    Army say na three members of di group die for dia hand, but di sect say na six of dia members die for army hand.  — (bbc__39447, __no translation__)
  68. Police hand
    Dino Melaye: Di Senator don faint for Police hand Dino Melaye: Di Senator don surrender to Police  — (bbc__40043, __no translation__)
  69. Police hand Dino
    Dino Melaye: Di Senator don faint for Police hand Dino!  — (bbc__40044, __no translation__)
  70. Switzerland hand
    Dis $321 million wey dem just promise to return na di latest for inside di Abacha money wey been dey Switzerland hand.  — (bbc__40112, __no translation__)
  71. hand grenades
    Recently, police arrest some three suspects wey dem say dey carry hand grenades for Odokor;  — (bbc__84809, __no translation__)
    Divisional police command for Ghana intercept seven hand grenades for Ghana after demma operation for Odokor.  — (bbc__43054, __no translation__)
  72. second hand smoke
    Dr Ryan Diver, wey be one of di pipo wey work for di project tok say, our findings show say to reduce second hand smoke for life dey important.  — (bbc__43436, __no translation__)
  73. years hand
    E don reach 58 years since Britain, wey bin dey colonize di kontri, hand ova give local politicians make dem dey run tins by diasef.  — (bbc__44343, __no translation__)
  74. contractors hand
    E don reach nearly two months wey videos comot wey claim to show how di govnor dey colect bribe moni from contractors hand for di state.  — (bbc__44351, __no translation__)
  75. hand efritin
    Earlier today, France investigators wey torchlight di plane flight data recorder and cockpit voice recorder - wey dem dey call black box - don announce today say dem check di information inside finish and dem don hand efritin back to Ethiopian authorities.  — (bbc__46220, __no translation__)
  76. boko haram hand
    Last year, Ladi Audu follow among di girls wey federal goment comot from boko haram hand.  — (bbc__63343, __no translation__)
    Federal goment say e action cause make plenti soldiers wey no dey equipped fall for boko haram hand.  — (bbc__48898, __no translation__)
  77. husband hand
    First dem comot power from her husband hand and now e be like say dem one collect one doctorate degree when University of Zimbabwe bin give Mrs Mugabe.  — (bbc__49225, __no translation__)
  78. pirates hand
    For January, bad-bad people hijack one ship for dat area, but dem release di ship six days later, after ransom money reach di pirates hand.  — (bbc__50260, __no translation__)
  79. hand Olusegun Obasanjo
    For di beginning of democracy, General Abdulsalami Abubakar wey be Muslim from di North Central for Niger state bin hand over power to Olusegun Obasanjo wey be Christian from di Southwest of Nigeria.  — (bbc__51036, __no translation__)
  80. family member hand
    For di number wey dey die, 30,000 na dia partner dey kill dem and almost 20,000 dey die for family member hand.  — (bbc__51223, __no translation__)
  81. hand power
    Army chiefs say dem dey comot criminals wey dey inside di ruling party Zany-PF, but dem go still hand power back to civilians.  — (bbc__52375, __no translation__)
  82. landlord hand
    She say she don see plenti tins for landlord hand.  — (bbc__55670, __no translation__)
    She say she don get two personal experience for landlord hand wey she no go ever forget.  — (bbc__79152, __no translation__)
  83. Nigeria police hand
    How Ghana stop ‘abochie knife’ takeover of Akufo-Addo goment Nigeria police hand over third Takoradi kidnapping suspect to Ghana  — (bbc__56254, __no translation__)
  84. hand clothes
    How second hand clothes dey reign for Nigeria  — (bbc__56598, __no translation__)
    Second hand clothes na any fashion item wey people don use before.  — (bbc__87289, __no translation__)
  85. Buhari hand
    Swearing in of Professor Yemi Osinbajo as Nigeria vice presido Who wan collect Osinbajo post for Buhari hand  — (bbc__92778, __no translation__)
    If we no kill corruption, corruption go destroy us - Buhari Who wan collect Osinbajo post for Buhari hand Nigeria security votes na 'wayo moni'  — (bbc__57803, __no translation__)
  86. Road Safety Corps hand
    Im say di federal power on top road and drivers dey Federal Road Safety Corps hand, so as to try make sure say tanker drivers get proper training and licence, say di vehicles wey dem dey drive dey okay and e no get fault.  — (bbc__59022, __no translation__)
  87. militants hand
    Di militants bin release all di oda girls but na only Leah wey be di only Christian among di girls still remain for di militants hand.  — (bbc__60531, __no translation__)
    Nigeria military don win back plenti land from di militants hand but till now di group still dey use suicide bombing to target military and ordinary pipo dem.  — (bbc__73848, __no translation__)
  88. criminal hand
    Kenya's Director of Public Prosecutions, Keriako Tobiko, don tell police and di agency wey dey fight corruption say make dem chook eye torchlight wetin happen and check whether any of di electoral commission members use criminal hand chook inside.  — (bbc__62285, __no translation__)
  89. 2018 World Cup Egypt hand
    As e be so na to pack dia load begin waka comot di 2018 World Cup na im remain for Egypt hand afta dem lose dia second match on Tuesday to Russia.  — (bbc__63198, __no translation__)
  90. term hand
    Last night all di Ministers wey bin work wit oga Buhari for im first term hand over to di Permanent Secretary for dia Ministries.  — (bbc__63241, __no translation__)
  91. EU hand
    Libya: EU hand no clean for migrant wahala - Amnesty International  — (bbc__63847, __no translation__)
  92. hand man
    MARCO LONGARI Joao na right hand man of the president wey dey comot  — (bbc__64408, __no translation__)
    Tori be say police don declare wanted Senator Melaye wey be right hand man of Senate President Saraki sake of accuse wey concern using of thugs to attack one police officer.  — (bbc__95285, __no translation__)
  93. Army hand
    Meanwhile, General Buratai through im lawyer, Akinlolu Kehinde, tell court say Kanu never ever dey di Nigerian Army hand.  — (bbc__66407, __no translation__)
    President Buhari go visit Yobe and oda states wia katakata dey happen Dapchi Girls: Police say no be true say Army hand over Dapchi to dem  — (bbc__83251, __no translation__)
  94. Ghana hand
    Money wey dey enter Ghana hand  — (bbc__67592, __no translation__)
  95. press hand
    More than 12.7 million people - about 79.5% of people wey don reach to vote - na im press hand for di vote wey last for eight weeks.  — (bbc__67690, __no translation__)
  96. healer hand
    Mr Magubane feel say im brother and three other young men, enter di traditional healer hand because dem no get work.  — (bbc__68362, __no translation__)
  97. trafficker hand
    She dey among 11 pikin wey dem see for trafficker hand.  — (bbc__70572, __no translation__)
  98. BBC hand
    Na for statement wey enter BBC hand na im South Africa Police Services say the government of Zimbabwe don tell dem say Mrs Mugabe na diplomat.  — (bbc__71092, __no translation__)
  99. dia hand
    Nigeria Police Police show tori pipo di suspects dem don arrest Nigeria Senate President Dr Bukola Saraki and Kwara State Govnor, Abdulfatah Ahmed, don deny Nigeria police accusation say dia hand follow for di Offa robbery wey happen for April dis year, wey police say kill 33 pipo.  — (bbc__73147, __no translation__)
  100. gofment hand
    One Nigerian man, wey save 262 Christians from killer herdsmen afta e hide dem inside im mosque don collect accolade from American gofment hand.  — (bbc__78081, __no translation__)
  101. crowd hand
    Or for di Nigerian, Endurance Amalawa wey chop correct beating for crowd hand as e dey waka for mall, on top say one Indian teenager die on top drug overdose, wey di pipo feel say na Nigerian drug dealers sell am give am.  — (bbc__79249, __no translation__)
  102. Croatia hand
    Pinnick say im don speak with di coach and players and dem dey sorry President of di Nigeria Football Federation Amaju Melvin Pinnick don declare say despite di 2-0 defeat wey di kontri suffer for Croatia hand on Saturday, di Super Eagles fit still reach di knockout round for di competition.  — (bbc__81364, __no translation__)
  103. attackers hand
    Police chief for Catalonia say blasts for one town wey dey south of Barcelona on Wednesday bin make bomb material no reach the attackers hand, na im make dem come decide to use van do am.  — (bbc__82338, __no translation__)
  104. hand gun
    Police talk say na one semi-automatic and two hand gun dem recover from where di thing happen.  — (bbc__82696, __no translation__)
  105. Markle hand
    Prince Charles, wey be Prince Harry papa, na him hold ms Markle hand waka inside St George's Chapel.  — (bbc__83823, __no translation__)
  106. Commission ICPC hand
    Yusuf case dey both EFCC and di Independent Corrupt Practices and other related offences Commission ICPC hand, untop accusation say im do magomago wey reach N919m.  — (bbc__84077, __no translation__)
  107. hand smoking
    Researchers for America Cancer Society tok say to dey let pikin dey do second hand smoking, dey add seven dead bodi for evri 100,000 wey no dey smoke evri year.  — (bbc__85034, __no translation__)
  108. hand smoke
    Second hand smoke no be only pikin problem Even if you no dey smoke, you fit still get smoking palava, especially if your papa or mama dey smoke.  — (bbc__87292, __no translation__)
  109. kidnappers hand
    Siasia mama don spend 30 days for kidnappers hand  — (bbc__89501, __no translation__)
    She dey hala for gofment and di international community to do sometin sharp sharp, make dem gain dia freedom from di kidnappers hand.  — (bbc__88514, __no translation__)
  110. soldier hand
    Since 2015 dem don detain am and im wife unto di killi killi of 349 of im followers for Nigerian military soldier hand for Zaria.  — (bbc__89670, __no translation__)
  111. SARS hand
    Since 2017 pipo don dey complain about di kain brutality and harassment wey dem dey suffer for SARS hand.  — (bbc__89681, __no translation__)
    Since last year, pipo don dey complain about di kain brutality and harassment wey dem dey suffer for SARS hand.  — (bbc__89857, __no translation__)
  112. wuruwuru hand
    Special counsel Robert Mueller dey investigate who follow Russia put wuruwuru hand inside 2016 election.  — (bbc__92077, __no translation__)
  113. hand washing stations
    Temperature screening points and hand washing stations dey for ground place for Rwandan border to control and prevent di spread of di disease.  — (bbc__93208, __no translation__)
  114. agency hand
    Tok-tok pesin for di Economic and Financial Crimes Commission ,Tony Orilade say di agency hand and leg no dey inside di mata, according to tori pipo Channels TV.  — (bbc__94562, __no translation__)
  115. tori pesin hand
    Tori be say Police Investigation Unit bin carri am go court on top tiff of secret documents wey no suppose dey dis tori pesin hand on to say e fit disturb di peace, scatta law and order even cause katakata inside di kontri.  — (bbc__94821, __no translation__)
  116. Babachir hand
    Tori be say one Nigeria Senate committee find out say Babachir hand dey inside one N200 million contract to cut grass for Yobe State.  — (bbc__95255, __no translation__)
  117. justice minister hand
    Afta like two minutes, she get herself back come shake di new justice minister hand.  — (bbc__97748, __no translation__)
  118. health insurance companies hand
    Wetin Nigerians don see for health insurance companies hand  — (bbc__99043, __no translation__)
  119. Cameroon hand
    Why CAF fit don comot 2019 AFCON from Cameroon hand Iwobi, Partey, Musa, Salah, and 30 odas go drag CAF men player of di year  — (bbc__100302, __no translation__)
  120. wife hand
    Zimbabwe vice president say im wife wey e wan divorce dey threaten im life Di new Vice president for Zimbabwe, Kembo Mohadi hala come out on Monday on top domestic violence wey im dey suffer from im wife hand  — (bbc__102181, __no translation__)
  121. komot hand
    wen dem tok sey dem wan komot hand as e bi for subsection of dis section, di paper wey dem for tok am go carry di exact date wey dem go komot hand/body.  — (hildrights__1352, __no translation__)
  122. lecturer hand
    still remain for dat lecturer hand.  — (deuber__1552, __no translation__)
  123. Opara hand
    And you dey shake im hand, you dey shake Opara hand.  — (deuber__4197, __no translation__)
  124. Vero hand
    But na for Papa Vero e hand di money dey.Hm?  — (deuber__4355, __no translation__)
  125. armi hand
    Make we all try helep police, as dem dey try to save us from armi robber dem hand.  — (deuber__5308, __no translation__)
  126. Moses hand
    Aaron and Hur hold Moses hand when Israel people dey fight.  — (jw__163, __no translation__)
    When Moses hand dey up, Jehovah go dey help Israel people win.  — (jw__26549, __no translation__)
  127. Egypt people hand
    After Jehovah save Israel people from Egypt people hand, e no tey, Amalek people come fight war with dem.  — (jw__468, __no translation__)
    As dem don free from Egypt people hand, dem see am as chance to do wetin dem like and to follow only wetin their body want.— Heb.  — (jw__12263, __no translation__)
  128. angel hand
    One thing be sey, angel hand dey inside.  — (jw__1557, __no translation__)
  129. religion hand
    Small time, God go save dem from fake religion hand.  — (jw__35879, __no translation__)
    Jehovah people come finally comot for fake religion hand.  — (jw__23505, __no translation__)
  130. boy hand
    As Brian see the cigar wey dey for the boy hand, im mind cut.  — (jw__2383, __no translation__)
  131. enemy hand
    David get hope sey after God save im people from their enemy hand, God go bless dem with plenty things, and dem go happy.  — (jw__36523, __no translation__)
    Zechariah still talk sey God go use am “save us from our enemy hand, we go get the strong mind to serve am well without fear.  — (jw__2933, __no translation__)
  132. doctor hand
    The truth be sey ‘e don suffer well well for many doctor hand and e don use everything wey e get, but e no still well, e come even bad pass before.’​— Mark 5:25, 26 .  — (jw__4365, __no translation__)
  133. servant hand
    Satan talk sey Jehovah no want make better thing reach Im servant hand, but that one na lie.  — (jw__4381, __no translation__)
  134. left hand side
    But e no dey my hand to choose who go sitdown for my right hand side or my left hand side.  — (jw__5236, __no translation__)
  135. darkness hand
    When Paul dey write give the Christian wey God choose with holy spirit like am, e sey: ‘E save us from darkness hand, come carry us put for the kingdom wey im Son wey e love well well get, because of am we don free because the ransom na im make God forgive our sin.’ We go fit enjoy many blessing because God dey forgive us.  — (jw__7514, __no translation__)
  136. Satan hand
    The things wey Job suffer for Satan hand really show sey Satan wicked.  — (jw__9812, __no translation__)
    Jehovah go answer our prayer, if we no stop to beg am make e free us from Satan hand.​— Psalm 145:19; Matthew 6:13 .  — (jw__42749, __no translation__)
  137. Philistia Ammon people hand
    For Jephthah time, Israel people suffer for Philistia and Ammon people hand because dem no do wetin Jehovah tell dem.  — (jw__11300, __no translation__)
  138. boys hand
    Many of us fit don suffer for armed robber or bad boys hand before.  — (jw__15429, __no translation__)
  139. Jehovah Witness people hand
    If government worker want collect bribe from Jehovah Witness people hand, many no dey gree give the worker because of wetin dem don learn for Bible.  — (jw__16155, __no translation__)
  140. hand rule
    Na Jesus and this 144,000 go join hand rule for that government wey dey heaven wey dem dey call God Kingdom— Revelation 14:1-3 .  — (jw__18205, __no translation__)
  141. Ammon people hand
    Jephthah know sey na only God fit help am save Israel people from Ammon people hand.  — (jw__19376, __no translation__)
  142. girl hand
    Jesus hold the girl hand and e tell am sey make e get up.  — (jw__25282, __no translation__)
    Jesus hold the girl hand and talk sey: “‘Talʹi·tha cuʹmi,’ if dem translate am, e mean: ‘Small girl, I sey make you “get up!”’” At once, the girl stand up and start to waka.  — (jw__21097, __no translation__)
  143. family people hand
    Jesus know sey people wey dey follow am go suffer from their family people hand.  — (jw__20920, __no translation__)
  144. king hand
    The message vex the king well well but Jehovah save the prophet from the king hand.  — (jw__21813, __no translation__)
  145. daughter hand
    The men come hold im hand, im wife hand and im two daughter hand.’ Dem come carry dem go outside the city.  — (jw__24095, __no translation__)
  146. Branch Committee hand
    Na Governing Body put this work for Branch Committee hand.  — (jw__25005, __no translation__)
  147. chain hand
    The container fit be clay pot wey get long chain hand and person fit gather hot charcoal from the fire wey dem light the night before the next day.  — (jw__28510, __no translation__)
  148. Rome hand
    One book wey be Backgrounds of Early Christianity talk sey: ‘Jew people enjoy plenty things for Rome hand.  — (jw__31425, __no translation__)
  149. Babylon hand
    Na to protect Jehovah people, especially from Babylon hand.  — (jw__42768, __no translation__)
  150. brothers hand
    Wetin we go do to show sey we dey make our brothers and sisters hand strong?  — (jw__43065, __no translation__)
  151. hand Pata Pata
    Bibe come increase their lead with one 53 meter drop goal to comot the game for benefica hand Pata Pata.  — (brila.cleaned__324, __no translation__)
  152. City hand
    Liverpool wey dey follow Man city drag title manage to kpokpo Wolves 2-0 kondo but their kpake no dey enough to kolobi the title from City hand as City finish on top 98 points while The reds finish ontop 97 points to take finish Second.  — (brila.cleaned__924, __no translation__)
  153. Guinea hand
    Nigeria na one of the strong countries wey dey the tournament but after the kpokporisation for Guinea hand join the plenty chances wey dem don miss, Manu Garba and im team go need to go back and find way to carry prepare wella for Brazil.  — (brila.cleaned__1182, __no translation__)
  154. Peru hand
    The Eaglets kpake the WAFU B U17 Tournament for inside Niger Republic for September last year to take kolobi ticket enter Tanzania and dem go dey hope to kolobi one of the tickets go the FIFA U17 World Cup finals wey go now shele for Brazil later this year after Fifa comot am for Peru hand.  — (brila.cleaned__1582, __no translation__)
  155. hand armi-robber-dem
    De say, di pipo of Offa town on Thursday, see nor-nor for di hand armi-robber-dem, wey attack and rob some five bank-dem inside di town and kill pipo anyhow.  — (ja102__1012, __no translation__)
  156. jaguda group hand
    Di Ministry ontop Defence-mata, for di contri, don yan say, dos dia us-made javelin missile-dem, wey dem no dey use again, wey dem suppose to don destroy, dem no know how e take reach dis jaguda group hand.  — (ja102__1812, __no translation__)
  157. strong-head hand
    Di government of America don katapot warning go give di oga presido of Gambia, Yahya Jammeh, say, make ein just respect ein-sef to step down from office and to avoid any okpetu wey fit won follo di strong-head wey ein dey show, if ein no hand over to di oga presido-elect, Adama Barrow.  — (ja102__1827, __no translation__)
  158. fall hand
    Meanwhile tori say N.P.F.L club-side, Ikorodu United go soon announce one Ogbonge coachee from Holland-yonda, to helep dem from di fall hand, wey dem don dey do for inside di league.  — (ja102__3031, __no translation__)
  159. hand cross
    I wan make una go crucify dat guy, knack, knack nail for im hand for cross.  — (IBA_42_Barrabas_DG__136, I want you to go and crucify that guy, bang, bang nail on his hand on the cross,)
  160. hand head
    Dem say de begin dey comot for di venue o as e be sey dem dey put hand for head say, wetin be dis?  — (IBA_38_News-Comment-By-Ogini_M__47, They said they started leaving the venu as it was that they were putting hand on their head that, what's this ?.)
  161. farmer hand
    Sunday, di person wey dey go carry di ting from farmer hand, dey come market, na im dey cause dis ting.  — (JOS_33_Changing-Nigeria_DG__111, Sunday, the person that goes to carry the thing from the farmer's, and comes to the market, it is them that are causing this thing.)====Synonymes====
  • mouth 0.68 1242, hands 0.68 154, bodi 0.66 1294, head 0.63 1697, mind 0.60 3840, body 0.59 1958, eye 0.58 2008, power 0.55 1862, leg 0.54 618

Translations

  • English: hand

VERB

  1. Sey dem give something
    • E hand am di tings  — (NSC_Ajede_2020,He gave him the things. )
  • English: hand, give