hand

Revision as of 18:59, 21 December 2021 by Shula (talk | contribs) (→‎Naija)

Naija

Etymology

From: English hand

Pronunciation

  • hánd

Play Play


NOUN

  1. Part of person body wey join shoulder wey person fit use hold or measure tings.
    • Fire con burn dis my hand,  — (ABJ_GWA_05_Tailoring_DG__3, Fire burnt this my hand.)
  2. Na sey person follow for something or join do something.
    • E dey people hand to choose.  — (jw__7602, __It's people's freedom to choose.)
  3. Wetin dem dey use dey measure tings.
    • Na one hand of rope I buy  — (NSC_Ajede_2020, It's a hand measurement of rope that I bought)
  4. Wetin person fit control/hold.
    • Even my younger broder now wey want, wey dem give admission, mstchew hm na God hand di ting dey.  — (ENU_03_School-Fees-And-French-Exams_DG__120, Even my younger brother now who wants... who was given admission, hm, it is in God's control)
    • Na to protect Jehovah people, especially from Babylon hand.  — (jw__42768, It's to protect Jehovah's people especially from Babylon's hold)

Derived forms

  1. Boko Haram people hand
    Di minister con come outside to yarn sey di same formula wey government use, wey de take release di eighty two Chibok girls wey de release so, plus di even before, before twenty one, na im de go still use take release di one wey be sey e remain for inside Boko Haram people hand as de take rub mind wit government and oda people,  — (WAZL_12_Chibok-Girls_M__7, The minister then came outside to say that the same formula that Government used to release the eighty two Chibok girls that were just released, plus the twenty one, that is what they will still use to release the ones that are remaining in the hands of Boko Haram, as they discussed with the government and other people.)
  2. monkey hand
    Meh you comot monkey hand for soup o before e turn to woman hand.  — (ENU_12_Social-Life_DG__21, They should remove the monkey's hand from the dish before it turns into a woman's.)
  3. woman hand
    Meh you comot monkey hand for soup o before e turn to woman hand.  — (NST_cleaned__4263, __no translation__)
    If you turn to woman hand, deir own, all of dem na de same thing,  — (ENU_12_Social-Life_DG__22, If you turn to a woman's hand, their own, all of them, it's the same thing.)
  4. hand grandma…
    Na two hand grandma… ,  — (NST_cleaned__8159, __no translation__)
  5. pikin hand
    So na small pikin hand fit enter, and na agbalagba go put hand.  — (IBA_05_Cobbler_DG__59, So, it's only a child's hand that can enter, but it is an adult that will put his hand.)
    How e go do you for body if you see person wey put im pikin hand for fire because the pikin do bad thing?  — (jw__42532, __no translation__)
  6. hand work
    When you learn work, hand work,…  — (NST_cleaned__13967, __no translation__)
    all of us na your hand work.’— Isa.  — (jw__5710, __no translation__)
  7. man hand
    Na so I collect for di man hand before di man go.  — (ONI_16_Thief_DG__167, That was how I collected it from the man's hand before the man left.)
    Drawing of man hand wey dey give Afghan currency to anoda pesin  — (bbc__43629, __no translation__)
  8. hand basin
    I dey enter shower quick-quick‚ once every three days‚ and for the rest I dey wash inside hand basin.  — (bbc__3358, __no translation__)
  9. iron hand
    I really give di military and police order to use iron hand.  — (bbc__3986, __no translation__)
    Di former Sudan president enta power for 1989, im rule one of Africa largest country until 2011- di year wey South Sudan break out with iron hand.  — (bbc__34679, __no translation__)
  10. APC hand
    Na so-so propaganda full APC hand - dem don dey manipulate foto and words tey-tey, tok Paul Ibe, wey be media adviser to Mr Abubakar.  — (bbc__5231, __no translation__)
  11. hand side
    E go back to heaven go sitdown for God right hand side  — (jw__8644, __no translation__)
    The police dey chase people…police dey left and people dey the right hand side.  — (bbc__6288, __no translation__)
  12. SARS officers hand
    Tope say na early dis year na im e jam palava for SARS officers dem hand: dem come say make I call my parents pay bail of N150,000. Na luck say my friend call one NGO wey come pay 25,000 naira.  — (bbc__6433, __no translation__)
    Tope tell BBC News Pidgin say na early dis year na im e jam palava for SARS officers dem hand: dem come say make I call my parents pay bail of N150,000....dem beat me...my ear pain me for two days, na wetin im talk.  — (bbc__6436, __no translation__)
  13. court hand
    We don arraign six of dem for court and now evertin dey di court hand to decide weda dem go grant dem bail or not. oga Elkana tok.  — (bbc__6834, __no translation__)
    Where e be sey proceedings wey di who be di papa of pikin or who be di mama of pikin na di court hand e dey to talk based on the proceedings, e dey get presumption of law sey di person dey legitimate if de give direction under section 63 for dis Act in di proceedings ;  — (hildrights__931, __no translation__)
  14. migrant hand
    From nowhere, one soldier use machete cut di migrant oda hand and ask am say, 'Which one dey pain you pass now?'  — (bbc__8281, __no translation__)
  15. regulator hand
    E dey for di regulator hand' to weed those wey no good out, im explain.  — (bbc__8795, __no translation__)
  1. But, dis resolution weh committee write fall for tori people dia hand, and deh di spread am for social media say Cameroon don sack Broos.  — (bbc__23846, __no translation__)
    Police Investigation Unit wan carri am go court on top tiff of secret documents wey no suppose dey dis tori pesin hand' on to say e fit disturb di peace, scatta law and order even cause katakata inside di kontri'.  — (bbc__9236, __no translation__)
  2. INEC hand Activists
    We dey suffer to get our PVC' - Nigerians INEC PVC deadline: Pipo like fire brigade #OneVoiceNigeria: Ten million PVC still dey INEC hand' - Activists  — (bbc__9356, __no translation__)
  3. Islamist militants Boko Haram hand
    AFP Di mama of di remaining Dapchi school girl wey still dey Islamist militants Boko Haram hand don tell tori pipo, say nobody for Nigeria goment don visit di family since her pikin miss.  — (bbc__9874, __no translation__)
  4. Nigeria hand
    Mr Kanu wife, Uchechi, say her husband dey Nigeria goment hand  — (bbc__68323, __no translation__)
    Den di money go come back to Nigeria hand after some weeks wey dem don agree on top.  — (bbc__30027, __no translation__)
  5. police hand
    Di 27-year old dey police hand now as im be suspect.  — (bbc__30444, __no translation__)
    Di driver dey Marine police hand as im go report imsef.  — (bbc__59566, __no translation__)
  6. hand sign
    Di 'OK' hand sign don become di latest hate symbol according to new report by di Anti-Defamation League .  — (bbc__30274, __no translation__)
    According to di ADL, di link of di OK hand sign to white nationalism bin start as fake news wey some users of one website 4chan, wey lie say di sign get links to white supremacy.  — (bbc__11734, __no translation__)
  7. factory hand
    For Ghana, dis former factory hand for Ashaiman, dey use dis all new innovation for di country recycle all plastic waste for di roads den landfill sites into pavement blocks.  — (bbc__12298, __no translation__)
    For Ghana one former factory hand for Ashaiman, Nelson Boateng start some all new innovation for di country as he dey recycle all plastic waste for di roads den landfill sites into pavement blocks.  — (bbc__50179, __no translation__)
  8. hand informate
    Acting tok-tok pesin for di EFCC, Tony Orilade, confam to BBC Pidgin say wen dem get first hand informate about dis yahoo-yahoo training school, dem come go undercover to burst di operation.  — (bbc__12324, __no translation__)
  9. INEC hand
    Adamawa suppose dey part of dem but one court order don tie INEC hand ontop di mata.  — (bbc__12399, __no translation__)
    She say dem go do di collation and announcement of results in a transparent way but she say dem no sabi who dey win but all di results dey intact for INEC hand.  — (bbc__88858, __no translation__)
  10. Atlantic sign' hand
    Akinwunmi Ambode Presido Buhari say wetin im do for di Eko Atlantic Project na to 'open sign' Presido Muhammadu Buhari hand don full in di last two days, as im dey correct pipo upandan for twitter about wetin im do and no do.  — (bbc__13559, __no translation__)
  11. mama hand
    Although dem no sure, di sabi pipo wey rescue Pony say dem collect her from her mama hand wen she be pikin and she spend like six years as prostitute for di hotel.  — (bbc__14455, __no translation__)
  12. government hand
    August - Transitional government hand over power to di General National Congress, wey dem elect for July.  — (bbc__17944, __no translation__)
    Ukan Kurugh wey dey among area people wey don dey respond to di tragedy say di people never see government hand.  — (bbc__97073, __no translation__)
  13. women hand
    No be small yabis she chop especially for women hand wey she say yab her pass men.  — (bbc__75027, __no translation__)
    BBC 100 Women don take eye analysis am, come see say Hollywood dey fall women hand as e concern dia mata.  — (bbc__18215, __no translation__)
  14. EFCC hand
    Babachir wey bin dey EFCC hand since Wednesday, waka comot on bail on Friday evening.  — (bbc__18895, __no translation__)
    Justice Peter Afen adjourn di mata to di June 3 for di hearing of dia bail application and order dem make dem still dey EFCC hand till dem get dia bail.  — (bbc__61605, __no translation__)
  15. hand day
    But afta all di event on Tuesday, na big question wey many pipo go dey ask go front how June 12 fit become di new hand ova day for evri goment.  — (bbc__21729, __no translation__)
  16. countries hand
    But di 1951 Convention no spell out how countries go use take determine whether person wey dey seek refugee status for dia country meet di criteria, na countries hand dat one dey to determine am.  — (bbc__22063, __no translation__)
  17. pastor hand
    But fans begin para wen video wey pipo dey share for social media show say di pastor hand press di musician breast as im dey hold her.  — (bbc__22687, __no translation__)
  18. goment hand
    Ngom say dis fight no be di type wey dem fit leave for goment hand or international partners.  — (bbc__72835, __no translation__)
    Im tink say if plenti pipo know about your wahala by say you put am for media, e fit move goment hand.  — (bbc__59621, __no translation__)
  19. kidnapper hand
    But some people still think say na correct thing say another Chibok girl don comot kidnapper hand go back dia house.  — (bbc__23494, __no translation__)
  20. Bashir hand
    But thousands of protesters still camp outside di Defence Ministry, dey demand make military rulers wey replace Bashir hand over power to civilians.  — (bbc__23554, __no translation__)
  21. bank hand
    CBN tell bank customers make dem no fear to report any mata wey don pass two weeks for any bank hand.  — (bbc__24040, __no translation__)
  22. security people hand
    Chief Horsfall say for di security people to still allow people wey suppose dey use cane pursue cow begin use AK-47 gun attack people inside di country, say security people hand dey inside.  — (bbc__25300, __no translation__)
  23. goalkeeper Charles Swini hand
    De Lions play beta dan for Comoros Island weh deh struggle for draw 1-1, but if de midfield and defence work beta, attack no work fain as na only deh shoot straight for goalkeeper Charles Swini e hand for first half.  — (bbc__27319, __no translation__)
  24. rain hand
    Dem also post photo dem of di kain scata-scata wey di state carri eye see for di rain hand on Monday.  — (bbc__28213, __no translation__)
  25. oga presido hand
    Dem fit recommend case but all di action dey for oga presido hand.  — (bbc__29087, __no translation__)
  26. second hand clothes
    Dem tok say dem dey import di second hand clothes and jackets and pipo wey no get money to enter boutique dey buy from dia hand.  — (bbc__29888, __no translation__)
  27. hand gloves
    Dey equally no wear hand gloves, boots and something to take to cover dia nose from dust.  — (bbc__30221, __no translation__)
  28. hand basins
    Di importers abi smugglers, pretend say na wash hand basins dey inside di ship.  — (bbc__35247, __no translation__)
    Di Customs Service say di smugglers carry di guns entre di country under pretence say na wash hand basins dem dey import.  — (bbc__31082, __no translation__)
  29. group hand
    She enta di militant group hand afta dem kidnap her comot her village for Borno state.  — (bbc__88610, __no translation__)
    Di Federal Government bin talk say na 101 girls be di total number of girls wey Boko Haram release but five of dem die for di group hand.  — (bbc__31295, __no translation__)
  30. hand post
    Di Nigerian International wey move go Everton dis summer from Arsenal come in for second half and almost score for im team, but im short hit di right hand post.  — (bbc__32037, __no translation__)
  31. All Progressive Congress hand
    Di PDP tok-tok pesin tok dis one as di party launch dia campaign council wit more than 150 members wey dia work go be to come up wit beta strategy to collect power from di ruling All Progressive Congress hand for 2019.  — (bbc__32161, __no translation__)
  32. Kano Hisbah Board hand
    Di case don enta Kano Hisbah Board hand  — (bbc__33449, __no translation__)


  1. wayo hand
    Di officials chop suspension sake of say dem allegedly award contract of N25 billion wit wayo hand.  — (bbc__36671, __no translation__)
  1. hand power
    Army chiefs say dem dey comot criminals wey dey inside di ruling party Zany-PF, but dem go still hand power back to civilians.  — (bbc__52375, __no translation__)



  1. komot hand
    wen dem tok sey dem wan komot hand as e bi for subsection of dis section, di paper wey dem for tok am go carry di exact date wey dem go komot hand/body.  — (hildrights__1352, __no translation__)


Translations

  • English: hand

VERB

  1. Sey dem give something
    • E hand am di tings  — (NSC_Ajede_2020,He gave him the things. )
  • English: hand, give