juju

Revision as of 12:05, 11 February 2021 by 154.66.32.3 (talk) (→‎Noun)

Naija

Etymology

From: French juojuo, Hausa jùjú

Pronunciation

  • dʒùdʒú

Play Play

Frequency

  • Frequency in NSC treebank: 1
  • Frequency rank in NSC treebank: 3622
  • Frequency in raw corpus: 128
  • Frequency rank in raw corpus: 1775

Noun

  • Na charm wey people dey use.
  • Di only tin wey you know na to dey do juju upandown.  —  Egbokare_2020. what you are good at is to go about making charms.)
  • Na so you talk sey I be, I dey believe in juju,  — (IBA_22_School-Children_DG__194, That is how you said I believe in charm.)
  • Meanwhile, menstruation na wahala wey dem dey feel say dey spoil di juju.  — (bbc__66599, _Meanwhile they claim menstruation spoils their charm_)
  • Na voodoo or black magic wey pesin send to anoda.
  • Na 'juju dem use for am wey im eyes take come down!  — (NSC_Legbeti_2021. They charmed him to get him to become subservient.)
  • While some dey think say e fit be juju wey some pipo send come di village from anoda place.  — (bbc__100058, _some think it was voodoo that was sent to the village from another place_)
  • Though na different version of dis match different people dey talk, all of dem gree say di Indians get chance to score all dis plenty goals because dem use juju, wey be black magic.  — (bbc__93819, _Though it was a different version of the match different people talked about, all of them agreed the Indians got a chance to score the much goals they scored because they used black magic)
  • Na all this thing worry am pass fear of juju or the bad people or even the forest.  — (katakata__537, _All these things scare him more than voodoo or bad people or the forest__)
  • Na small god wey pipu make and dem dey worship
  • Ahab and im wife, Jezebel, dey serve one juju wey dem dey call Baal.  — (jw__4004, Ahab and his wife Jezebel serve one god called Baal.)
  • Jehoiada tell dem make dem scatter all the juju temple and pieces all the juju.  — (jw_17655, Jehoida told them to scatter the temple of the gods and destroy the gods_)
  • Except you change your lifestyle, and begin dey tink of God, except you leave di old way wey you dey worship oder juju, oder tings, and begin dey worship di true God wey dey heaven, you no go fit do wetin I dey do.  — (NST_cleaned__38305, _except you change and leave your old ways of worshipping small gods behind and begin to worship the true God you will not do what I do_)
  • After that one, Jehu come kill Ahab 70 boy pikin, e still comot all the juju from the land.  — (jw__885,After that, Jehu now killed the 70 sons of Ahab and destroyed the gods of the land)

Related forms

jujuman, jujumusic

Synonyms

Antonyms

Translations

  • English: charms, small gods